Olubadan of Ibadan: Oba Saliu Adetunji don pass away at age 93

Di Olubadan of Ibadan land, Oba Saliu Adetunji Ajeoguguniso 1 don pass away.

Na for private hospital for Ibadan, Oyo state, dem comfam im passing on Sunday morning, January 2, 2022.

Im bin dey 93-years-old.

BBC Pidgin follow confam di mata afta we carry waka go di palace.

Well-wishers and member of di royal show up for di palace afta di news break and for inside di compound, we see say some pipi dey arrange one side wey dem believe na di site dem go bury im bodi.

But nobody don see di King bodi and tori pipo still dey wait to hear from Oba tok tok pesin on wetin be di cause of death.

Until im passing, Oba Saliu Adetunji Ajeogunguniso II be di 41st Olubadan of Ibadan for Oyo state, southwest Nigeria.

Biography of Oba Saliu Adetunji

Dem born di late Saliu Akanmu Adetunji on August 26, 1928 for Adetunji, Popoyemoja area of Ibadan.

Before im turn established businessman, e start off to dey sew cloth.

Later e come start record label business for Lagos. Di company name be Economy Records.

Some of di wey dey signed to di label dat time be Dauda Epo Akara, Tatalo Aremu, Amuda Agboluaje, Wasiu Ayinde K1, and Jimoh Ayinla Anikura.

E later change di name to Babalaje Records.

How e take become oba

According to di monarchy for Ibadan, Saliu Akanmu Adetunji bin join di Adetunji family for 1976.

On April 4, 2016, di den Oyo state govnor the late Abiola Ajimobi bin inaguarate Oba Adetunji as di 41st Olubadan of Ibadan.

Before den, im bin serve for 23 years unda di former ruler, Oba Samuel Odulana.