You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Desmond Tutu: Body of South African hero go dey aquamated - Check out wetin e mean
Di late anti-apartheid campaigner Archbishop Desmond Tutu body go dey aquamated.
Aquation na process of using water wey dey described as environmentally friendly to dispose di body instead of cremation - to burn di body wit fire.
Dis na "wetin e want as an eco-warrior," Very Rev Michael Weeder tok.
Thousands of South Africans don dey pay their last respects for St George's Cathedral for Cape Town where Tutu body dey lie in state.
Plenty emotions don flow dey since im death one week ago at di age of 90.
Archbishop Desmond Tutu burial dey expected to take place dis weekend.
E neva clear whether im family go choose private or public ceremony.
Before im death, e insist say im no want any "no ostentatiousness or lavish spending" on top di ceremony and make dem bury am for "di cheapest available coffin", wit di only flowers for di cathedral as "a bouquet of carnations from im family", according to di Archbishop Tutu IP Trust and di Desmond and Leah Tutu Legacy Foundation.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem go bury im ashes behind di pulpit for St George Cathedral for Cape Town - di Anglican diocese where e serve as Archbishop for 35 years.
Wetin be aquamation?
Aquamation, na use of water to dispose human or pets.
E dey hyped as a greener alternative wey better pass cremation, wey dey use fire.
Practitioners say e cut di amount of environmentally harmful carbon dioxide produced by up to 90%.
Di technical name for di process na alkaline hydrolysis - and e involve to weight di body and heat am up to 150C (300F) inside mixture of potassium hydroxide and water for up to 90 minutes.
Dis go dissolve di body tissue and reduce am to only bones - wey dem go rinse at 120C, dry, and grind into coarse powder wit one machine dem dey call cremulator.
Once all these steps don complete, di remains fit dey buried or scattered according to di deceased wishes - just as dem dey do for ordinary cremation.