Cubana Chief Priest: Why EFCC arrest Cubana Chief Priest

Wia dis foto come from, Instagram/@cubana_chiefpriest
Nigeria anti-corruption police, EFCC don arrest popular socialite Pascal Okechukwu alias Cubana Chief Priest, according to reports.
Di Economic and Financial Crimes Commission arrest Cubana Chief Priest on charges wey border on money laundering and tax fraud, local media dey report.
According to di report wey dey fly upandan, EFCC gbab am for Lagos airport on Thursday, but dem no let pipo for public know about dis sake of pressure from im associates and family, wey say di mata fit complicate conditions for oda wey likely dey connected to di alleged charge.
BBC Pidgin neva fit independently confam dis report as EFCC spokesman Wilson Uwujaren neva respond to our calls and messages.
- Husband of over ten years allegedly burn wife, brother-in-law alive over 'property'
- EFCC reveal why Obinna Cubana dey with dem- See how Nigerians react
- 'I dey face my challenges now' - Obi Cubana share im experience afta NDLEA quiz am
- Nigerians react as Cubana Chief Priest 'buy 46 cows' for im Oga
- Cubana Chief Priest regain freedom afta EFCC 'arrest'
Cubana Chief Priest never post anything for im official Instagram account since di report of im arrest come out.
Fi last time e post for social media na four days ago and na video of am watching di Nigeria vs Ghana match for stadium.
Who be Cubana Chief Priest?

Wia dis foto come from, Instagram/@cubana_chiefpriest
Cubana Chief Priest wey also call imsef Celebrity barman real name na Pascal Chibuike Okechukwu.
Im na business man wey get big investment for entertainment and showbiz - na im get Club Xhrine for Owerri, Imo state.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem born Cubana Chief Priest for Umuhu Okabia, Orsu Local Government Area of Imo state.
Na im be di second son of im parents wey train am for Aba, Abia state wia im learn shoemaking.
Cubana Chief Priest later attend Federal Polytechnic Nekede Owerri, wia im earn im first degree.
For early 2021 im bag degree as Doctorate of Science for Event and Luxury Hospitality Management from European American university - im announce di degree on im Instagram page on Saturday, April 24, 2021.
Pascal Chibuike Okechukwu aka Cubana Chief Priest get wife and children.












