Oluwo of Iwo: Osun goment react to letter wey say Oluwo ask state to sponsor im wedding wit 20 million Naira

Oluwo of Iwo

Wia dis foto come from, Oluwo of Iwo

Osun State Government don tok say letter wey dey circulate for social media wey say Oba Abdulrasheed Adewale Akanbi, dey ask for di sum of Twenty Million Naira from Governor Adegboyega Oyetola to finance im proposed marriage to di daughter of di Emir of Kano, Ado Bayero na fake letter.

For inside statement signed by di Osun State Commissioner for information, Funke Egbemode, Osun goment tok say di letter na attempt by mago-mago pipo to cause gbege between di governor and di citizens of di state.

Di letter dem tittle 'Notification of wedding and request for financial support" bin go viral on social media on Friday.

"As a goment e dey important to stop pipo wey dey carry negative report in dia tracks", Osun goment tok.

"E no dey come as a surprise especially as di state dey draw closer to im gubernatorial primaries and election",

"We beg di good pipo of Osun to ignore all insinuations wey dem wan use stain di governor and im government.", dem add for statement.

Wetin dey inside di letter?

Di letter read: "I get di instruction of im imperial Majesty Oba (DR.) Abdul-Rasheed Adewale Akandbi, di Oluwo of Iwo to notify you of di Oluwo decision to marry a princess from Kano Emirate.

Di letter mention say di princess na precisely from di Ado Bayero dynasty.

"I wish to remind your Excellency say dis kain royal wedding within two notable traditional institutions for Nigeria go need huge expenses.

"E go need support of di state goment financially even wit logistics."

Di letter say di estimated amount for di event dey above 20 million Naira.

"Im excellency , Oba Akanbi go rely on una - Osun state goment- for necessary consideration and approval on dis request".

Oluwo letter

Wia dis foto come from, Oluwo letter

Wetin di Oluwo of Iwo tok?

Oluwo don deny say im write dis kain letter to Osun state goment.

Oba Abdulrasheed Adewale Akanbi say im no send invitation to di State goment to support am wit 20 million naira for wedding.

Oba Abdul-Rasheed Adewale tok for interview wit BBC say na fake letter pipo dey circulate for social media

Na true say Oluwo wan marry?

Oluwo confam give BBC say true-true im wan do wedding

E no confam if na Princess from Ado Bayero dynasty but e say na from Kano im wan marry.

E neva tok di date of di wedding ceremony give BBC, but e say dem go make am public wen di time reach.

Oluwo and im former wife, Queen Chanel Chin bin part ways for December 2019.

Wetin to sabi about di Oluwo of Iwoland

Oba Abdulrasheed Adewale Akanbi Ilufemiloye Telu 1 na di 16th pesin to become di Oluwo of Iwoland

Dem born am on 21 June, 1967 to di family of late Prince Kola Akanbi of Molasan Compound, Gbaase Ruling House, Iwo, Osun State for South West Nigeria.

Oba Abdulrasheed become di Oluwo of Iwo for November 2015 wen im be 48 years.

Since im become King, plenti controversies don surround am

Popularly for Yorubaland, na Kings dey wear crown but Oba Abdulrasheed allow im former wife, Queen Chanel Chin to wear crown like King.

Plenti pipo criticise am say e no dey right for Queen to dey wear am but im tell tori pipo say di pipo wey dey bad mouth am no sabi culture.

"Di first queen of Oduduwa (first Yoruba king), Olokun dey wear crown. Any king from di lineage of Oduduwa suppose allow im Queen to wear crown," im tok.

For December 2019, Oba Akanbi release press statement to inform pipo say im don divorce im wife.

For di statement e say "Sake of personal differences wey we no fit reconcile, Chanel Chin no be im Majesty Queen again. We ask di public make dem no do any business transaction with her or make any request dey use her office as Queen, We wish her all di best for her new joni."