Mompha arrest: Why Nigeria anti-corruption police re-arrest Mompha again

EFCC arrest Mompha: Why Nigeria anti-corruption police re-arrest Mompha again

Wia dis foto come from, Instagram/@mompha

Internet celebrity, Ismailia Mustapha, wey pipo know as Mompha don plead not guilty to di fresh charges against am.

Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) arraign Mompha and im company Ismalob Global Investment Limited on eight counts for alleged money laundering to di tune of over N6billion.

E appear before Justice Mojisola Dada of di Ikeja Special Offences Court on Wednesday.

EFCC Charges against Mompha

EFCC arrest Mompha: Why Nigeria anti-corruption police re-arrest Mompha again

Wia dis foto come from, Instagram/@mompha

One of di charges na say Mompha and Ismalob allegedly conspire to launder funds dem obtain through unlawful activity, retention of di funds, transfer of funds for a suspect Olayinka Jimoh a.k.a Nappy Boy, and unlawful transfer of funds for a record label, among odas.

According to di charge, di amount of money wey dey involve na N5,998,884.653.18, N32million, N120million and N15,960,000, totalling over N6billion.

EFCC also allege say Mompha hide im interest for expensive wristwatches and iPhone wey worth over N70million.

Court order detention of Mompha

Afta Mompha plead not guilty to di charges EFCC Lawyer, Rotimi Oyedepo apply for trial date.

Meanwhile, di suspect Lawyer Gboyega Oyewole tell court say e don file bail application.

Justice Dada afta hearing di argument order say make dem detain Mompha for EFCC custody.

Court fix January 18 as dat wey di trial go start.

Nigeria anti-corruption police, EFCC bin re-arrest popular businessman, Ismaila Mustapha - di arrest come afta e post foto of imsef inside plane and announce for social media say e just land Nigeria.

"SkyMan don land Nigeria. About to make some billions in Lagos," Mompha write as caption for post on im instagram page.

EFCC arrest Mompha: Why Nigeria anti-corruption police re-arrest Mompha again

Wia dis foto come from, Instagram/@mompha

Mompha history wit EFCC

Dis no be di first time wey di popular businessman dey face arrest on top allegation wey di Economic and Financial Crimes Commission sama am.

For October 2019, Nigeria Immigration Service bin arrest Mompha for Nnamdi Azikiwe International Airport as e dey board Emirates Airline Flight go Dubai afta one watch list wey EFCC release.

EFCC later drag Mompha go court on top charges say e launder moni through one company, Ismalob Global Investment Limited between 2015 and 2018.

Den for August 2020, EFCC arrest Mompha again on top fresh investigation wey link to suspected Yahoo-Yahoo alias internet fraud.

During dat time EFCC bin tell BBC say dis fresh case wey dem use take arrest Mompha dey different from di one wey dem bin sama against am earlier on.

"You know we already dey court with am before, we get fresh information now and we go give further development about am later,"Head of Media & Publicity then for EFCC, Dele Oyewale tok.