See how much di Nigeria Senate add to pass budget of N17.126 trillion to finance di kontri for 2022

Wia dis foto come from, NIgerian Senate
Nigeria Senate don pass di kontri budget for di 2022 financial year.
Di Senate, on Wednesday, pass di budget afta dem add N800 billion to increase di first estimated budget of N16.4 trillion wey President Muhammadu Buhari present to N17.126 trillion.
Dis na 24hours afta di House of Representatives don already pass di budget.
Di Senate also increase oil benchmark price from $57 wey di executive arm of goment bin propose to $62 to reflect current international market condition.
But dem leave exchange rate as e bin be for N410.15.
Dem pass di budget afta dem consider di recommendations from report wey chairman of di Senate Committee on Appropriation, Barau Jibrin present.
For im presentation, Oga Barau say, out of di total sum of N17.126trn for di fiscal year 2022, N869.6bn na for Statutory transfers; N3.8trn na for Debt Service; N6.9trn na for Recurrent Expenditure; and N5.4trn for Capital Expenditure.
See state wey don pass dia own budget
Just as many Nigerians dey wonda weda di kontri fit really di budget as dem dey look how much di kontri go borrow, some states too dona already pass dia budgets.
End of Di one wey oda users dey read well well
Rivers state govnor Nyesom Wike sign N483.1bn 2022 budget into law. Im say im administration go mobilise resources to implement 80 percent of wetin dey dia 2022 budget.
Kaduna state govnor Nasir El-Rufai sign N278.58bn 2022 budget into law. Di signed budget allocate N184.53bn to capital expenditure and N94.05bn to recurrent expenditure.
E assure residents say dem go faithfully implement di budget to advance public welfare and develop human capital and infrastructure.

Wia dis foto come from, Nigeria government
Kano state govnor, Umar Ganduje sign over N221 billion budget for 2022.
E tag am as" Budget for Consolidation and prosperity"
Ganduje say di budget wey get high priority and percentage for capital projects go dey implemented beginning from 1 January, 2022.
Gombe sign N154.9 billion 2022 budget into law.
Di Govnor Muhammad Inuwa Yahaya say before dem present di bill, dem bin arrange public hearings and that na wetin form dia basis for di budget preparations.
Di budget na also be "Budget of Consolidation".
Akwa Ibom also sign dia 2022 Appropriation Bill of N586.88 billion.
Govnor Udom Emmanuel name am: "Budget of Redefining Standards".
Oyo state govnor, Seyi Makinde sign N249.7 billion as di 2022 budget.
Makinde wey say na "budget of growth and opportunities" as e explain say di budget go accommodate more development projects for di state.














