Sani Dangote dies: Aliko Dangote brother Sani, Vice President of Dangote Group don die

Wia dis foto come from, Dangote Group
Di number two man in charge of Dangote group don die, di company don announce.
Sani Dangote, wey also be brother to Africa richest man Aliko Dangote, die on Sunday.
Di organization neva confam di cause of Sani death.
Local reports say di Vice President of Dangote group die for United States of America afta one long sickness.
Aliko Dangote brother Sani Dangote death na painful exit, according to di company announcement.

Wia dis foto come from, DANGOTE GROUP
Sani Dangote profile
Although e no dey popular as im brother, Aliko Dangote but Oga Sani na businessman.
Before im death, Sani Dangote bin don get investments in key sectors of di economy wey include manufacturing, agriculture, banking.
E dey di board of plenty other companies like di Nigerian Textile Mills Plc, Nutra Sweet Limited, Gum Arabic Limited, Dangote Textile Mills Limited.
End of Di one wey oda users dey read well well
Aliko Dangote brother also dey board for Alsan Insurance Brokers, Dan-Hydro Company Limited, Dansa Food Processing Company Limited and Dangote Farms Limited.
E also be di Deputy Chairman of di African Gum Arabic Producers Association and two-time President of Lagos Polo Club.
Sani also be professional polo player.
Sake of im ogbonge leadership qualities, e dey appointed as di Consul-General of di Romanian Embassy for Nigeria.
E be member of several Chambers of Commerce, Fellow of di Chartered Institute of Shipping of Nigeria and President of di Fertiliser Producers and Suppliers Association ("FERSAN").

Wia dis foto come from, Other
Former Vice President, Atiku Abubakar, former Senate President Bukola Saraki plus oda ogbonge Nigerians don tok sorry to di family of Aliko Dangote.
Govnor Abdullahi Ganduje of Kano, Govnor Sani Bello of Niger too dey mourn di death of im brother, Sani Dangote.
Di Dangotes belong to di influential Dantata family for Kano, northwest Nigeria.
Aliko Dangote profile
Aliko Dangote na di founder and president/chief executive of di Dangote Group.
Dangote Group di largest conglomerate for West Africa.
Di group currently dey for 17 African kontris and e dey lead di market on cement for di continent.
Internationally, Dangote dey sit on di board of di Corporate Council on Africa.
And e be member of di Steering Committee of di United Nations Secretary-General's Global Education First Initiative, di Clinton Global Initiative, di McKinsey Advisory Council.
E also be board member for di International Business Council of di World Economic Forum.
Di US Chamber of Commerce name am Co-chair of di US-Africa Business Center, for September 2016.

Wia dis foto come from, DANGOTE GROUP
For April 2017, e join di Board of Directors of di Clinton Health Access Initiative, wey dey help kontris to build di systems wey dey necessary to provide health services to dia pipo.
Aliko Dangote na dedicated philanthropist.
E make im initial endowment of $1.25 billion give di Dangote Foundation for March 2014, wey enable am to scale up dia work in health, education and economic empowerment.
In addition, e dey collabo wit di Bill and Melinda Gates Foundation to fight polio. E also dey di Board of ONE, di anti-poverty group, wey dey co-founded by Bono.
Aliko na graduate of Al-Azahar University for Cairo, Egypt.
E begin im business career for 1978, wit di trade of rice, sugar and cement, before e venture into full-scale manufacturing.
For 2013, Forbes list am as di 'Most Powerful Man for Africa.'
April 2014, TIME Magazine list am among di 100 'Most Influential People for di World.'
He also make di list of CNBC's 'Top 25 Businessmen for di World' wey change and shape di century.















