Brigadier General Dzarma Zirkusu: IS claim killing Nigeria army general, sojas for Borno

"Brigadier General Dzarma Zirkusu": Islamic State claims responsibility for killing Nigeria army general, sojas for Borno

Wia dis foto come from, @TomaszRolbiecki

Islamic State don claim responsibility for di attack on Nigeria sojas wey kill Brigadier General Dzarma Zirkusu on Saturday.

Di militant group [ISIS] drop di claim for dia Telegram account hours afta di deadly attack for northeast Nigeria, according to Reuters.

Four soldiers wey include one army general die for di ambush attack for Borno state.

Before dem kill Brigadier General Dzarma Kennedy Zirkusu, plenti ISWAP militants don dey killed, according to tori.

According to report, di army unit bin dey on dia way to reinforce sojas wey bin dey fight serious battle wit di insurgents.

Di IS Telegram message say apart from three more soldiers and a high-ranking military official - dem kill 17 in total - wen di army send reinforcements to confront di jihadists.

E say IS militants bin "raid" Askira Uba on 13 November and attack one army base inside di town.

Na dis one come triggers "serious clashes" between di two sides and allegedly leading to di death of 13 soldiers.

President Muhammadu Buhari don express im sadness at di deaths of di sojas say dem pay di ultimate sacrifice to protect fellow Nigerians from terror.

Nigeria Army say na suspected ISWAP kill general, sojas for Borno attack

Brigadier General Dzarma Zirkusu: IS claim killing Nigeria army general, sojas for Borno

Wia dis foto come from, Getty Images

One Nigerian army Brigadier General plus three oda sojas na im suspected militants kill for Saturday fresh attack for Borno State.

Suspected fighters of di Islamic State of West Africa Province (ISWAP) engage for gun battle with troops for one military base inside north east part of di kontri.

For statement wey Nigeria Army put out on Saturday afternoon dem say:

Dzarma Zirkusu and di oda soldiers die for Askira/Uba Local Government Area of Borno State wia di military base dey.

Brigadier General Dzarma Zirkushu profile

Nigeria Army news: Brigadier General Dzarma Zirkusu death sadden Buhari

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Brigadier General Dzarma Kennedy Zirkushu

Brigadier General Dzarma Kennedy Zirkushu na senior oga wey be Commander of 28 Task Force Brigade for Borno State, northeast Nigeria.

Na him Brigade dey do regular clearance of Boko Haram insurgents for Borno State wey don suffer many militant attacks.

From time to time sojas and commanders for dis 28 Task Force Brigade dey clear and liberate some villages.

Dzarma Zirkusu and di oda soldiers die for Askira/Uba Local Government Area of Southern Borno State wia di military base dey.

Tori be say di suspected militants ambush Brigadier General Dzarma Zirkusu motor for Chibok road wia dem kill am.

President Buhari say e don ask di Chief of Army Staff to accept im heartfelt condolences and dat of Nigeria.

E also send im condolences to members of di families of di soldiers wey im call 'martyred.'

Brigadier General Dzarma Zirkusu: IS claim killing Nigeria army general, sojas for Borno

Wia dis foto come from, Getty Images

Di army, inside statement wey BBC Pidgin see on Saturday, say dia troop successfully defend di location.

At di time di Army release dis report, di Air Component of Operation Hadan Kai send five A - Jet.

Dem also send two A-29, two Dragon combat vehicles come destory nine Gun Trucks and One APC.

Brigadier General Dzarma Zirkusu: IS claim killing Nigeria army general, sojas for Borno

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, One Nigerian army Brigadier General plus three oda sojas don die for one militant attack for Borno State.

Attacks on military base don dey dey become worrisome pattern for Nigeria.

Deputy Speaker of Borno House Assembly, Engr Abdullahi Musa Askira, tell local tori pipo Daily Trust say:

Di insurgents and troops dey currently exchanging gunfire, "but di residents dey inside di bush."

Di Nigeria Army statement add say di Chief of Army Staff don tell sorry give di families and relations of di general and three soldiers wey die.

Lieutenant General Faruk Yahaya also direct make di troops continue aggressive counter attack and pusue to eliminate di remaining insurgents wey dey run.