Emmanuella Ropo Kwam 1 new wife: Meet Emmanuella Aderopo, King Wasiu Ayinde Marshal 1 bride

Wia dis foto come from, Kwam1
Emmanuella Aderopo na di latest woman inside popular Nigerian Fuji singer Kwam 1 life.
King Wasiu Ayinde Marshal 1, aka Kwam 1 and Emmanuella wedding finally take place for Abeokuta on Thursday, 18 November, 2021.
Di Yoruba music legend wey many dey call K1 de Ultimate dey like call dis im new wife 'Nuella Ajike Mi',
So who be Emmanuella Ropo? - As evribodi dey call Kwam 1 new wife?
BBC Pidgin don gada informate to help you sabi Emmanuella Ropo profile.
Meet Emmanuella Ropo
Emmanuella Aderopo na titled chief inside Otun Igbehin, Abeokuta, Ogun State.
She get traditional title of Otun Iyalode of Igbehin in Abeokuta.
Kwam 1 new wife don born pikin from a previous marriage.
End of Di one wey oda users dey read well well
Also Kwam 1 also get odar wives wey don born am pikins.
Her papa wey don die, Stephen Gboyega Odebiyi, na respected Egba chief.
During her father burial reception on June 17, Kwam 1 bin deybandstand to entertain her guests.
Emmanuella, believed to be in her 40s na businesswoman.
She dey operate children boutique and gifts store, Partydreams for Lagos.
She bin attend Yaba College of Technology wia she study Estate Management.
Emmanuella na practicing Christian before meeting K1 de Ultimate.

Wia dis foto come from, EmMANUELLA Ropo/Instagram
Emmanuella fit be first of Kwam1 wives wey im go would openly display and praise on im official social media pages.
Tori be say na so Emmanuella too dey mark her territory around Kwam1.
She once write about di 64-year-old Fuji Musician ontop her Insgram page saying:
"My heart dey bleed love for you and e dey fuel my entire being. I bin get ideas about wetin you fi be, but you scata those thinking and replace dem with a reality beyond my wildest dreams.
"Men like you dem no fit find dem anymore, You don manage to win both my heart and soul," Emmanuella write.
So far, di singer don dey legally married to some of these women including Titi Masha and Yewande, wey dey live for Canada with her children. Dem still dey married.

Wia dis foto come from, Kwam 1 fans club
Who be Kwam 1 - King Wasiu Ayinde
KWAM 1 name come from King Wasiu Ayinde Marshal I.
Di Oba of Lagos, Oba Adeyinka Oyekan install am as di Olu Omo of Lagos.
E start im hustle from downtown Okota - Lagos.
Born 3 March 1957, di 64-year-old get many pikins from oda women.
Wasiu Ayinde Marshal na Muslim. KWAM 1 get a long playlist of Albums.
Na di singer make popular a brand of di fuji genre based on di work of the fuji creator Ayinde Barrister known as Talazo fuji.
King Wasiu Ayinde Marshal I aka K1 de Ultimate songs dey appeal to all age groups, irrespective of tribe and background.
















