Collapsed building in Ikoyi Lagos: How 21 storey building for Gerrard road fall, trap many

Building collapse in Lagos: Ikoyi 21 storey building collapse for Gerald Road, many trap
Wetin we call dis foto, Eyewitness claim say di building wey fall down na 21 storey, while buildings standing beside am na 14 storey.

Recuse operation go into di night for di 21-storey building wey collapse for Ikoyi area of Lagos, Nigeria commercial capital.

Witnesses say many pipo fit dey trapped for inside di high-rise building wey collapse on Monday 1 November, 2021.

One eyewitness say around 2:25pm dem notice say everywia bin dey shake and later di tall building fall down.

Na for Gerrard Road, Ikoyi na im di multiple storey building collapse, authorities tok.

BBC Pidgin find out say di Lagos high-rise-building na active construction site wen e crash.

But authorities for Nigeria commercial capital say dem no go fit easily give di exact number of those wey dey trapped inside di buried skyscraper.

More pipo dey inside di roubles, according to those wey use eye see wen di 21-storey go down.

Rescuers don comot at least 10 pipo from di rubble for di collapsed building, at di time BBC Pidgin update dis tori.

E however no dey clear how many weda all of dem dey alive. Rescuers move some of dem into waiting ambulance.

Building collapse in Lagos: Ikoyi 21 storey building collapse for Gerald Road, many trap
Wetin we call dis foto, Pesin wey dem rescue on Monday afternoon from Ikoyi Building collapse.

Once Red Cross official account na say dem don confam about five pipo dead.

Dis account say two of di deadi bodi dem dey mangled on top of di building.

And dem need to cut to get to di pipo wey dey trapped.

But Lagos state Police command wey dey on ground for di scene of di collapse say dem fit confirm at least three pipo dead and six rescued.

Workers on-site don manage rescue just two pipo alive.

Building collapse in Lagos: Ikoyi 21 storey building collapse for Gerald Road, many trap
Wetin we call dis foto, Tori be say dis car wey tori pipo see for di scene of di building collapse fit belong to someone wey fit still dey trapped inside di building.

Lagos State Emergency Service, LASEMA say di agency don activate im emergency response plan to di above incident.

And rescuers still dey on ground to see if more pipo dey trapped, LASEMA add.

All first responders dey on dia way to secure di scene as dem don already dispatch di heavy duty equipment and life detection equipment.

Building collapse in Lagos: Ikoyi 21 storey building collapse for Gerald Road, many trap

Officials of di Lagos Building Control Agency no gree speak on di building collapse at dis time.

Dem insist say dem no get a full sense of wetin happun.

And dem no even get confirmed information on how many pipo dey trapped inside.

Building collapse in Lagos: Ikoyi 21 storey building collapse for Gerald Road, many trap

Lagos state goment later put out statement say dem don save at least three pesins alive from di collapsed 21-storey building.

Authorities also say dem don block off di location make e help rescue efforts and access to di site.

And now dem dey conduct on-di-spot assessment of any likely damage to di surrounding structures for di area, di goment tok on Monday night.

Ikoyi building collapse fotos

Building collapse in Lagos: Ikoyi 21 storey building collapse for Gerald Road, many trap

Wia dis foto come from, lasema

Wia dis foto come from, LASEMA

Building collapse for Ikoyi

Collapsed building in Ikoyi Lagos: Wetin we know about 21 storey building for Gerrard road

Di 21 storey building wey collapse dey located for 44BCD Gerrard Road, Ikoyi, one suburb area for di rich inside Lagos.

Na 4 Score Homes dey handle di construction of di project according to di informate wey dey di sign post in front of di collapsed building.

And di owner alias client of di building wey bin dey under construction na FHL - Fourscore Hieghts Limited.

Di structural engineers na Beyond designs while di architects na Voltron Design Studio. M&E na di consultants in charge of di construction.

Meanwhile, Prowess Engineering Limited wey bin dey in charge of di 21 storey building initially comot hand for di construction.

Dem comot bodi for February 2021 sake of say dem no share di same vision wit how di owner of di building dey carry out di project.

Prowess Engineering for inside letter wey dey dated to 20th February bin address am to one Mr Femi Osibona for Fourscore Heights Limited.

Dat time dem say dia intention to formally withdraw dia structural consultancy service from di "Proposed Gerrard Terraces for Fourscore Limited."

Building collapse in Lagos: Ikoyi 21 storey building collapse for Gerald Road, many trap

Civil engineers wey sabi dis kain constructions say e go require massive excavation, digging through di huge rubble and mangled irons, to be able to save those wey dey trapped inside.

President Muhammadu Buhari don tok sorry give families wey don lost loved ones inside di Lagos building collapse while some still dey trapped.

President Buhari encourage authorities to step up efforts in rescue operations.

Di Nigerian leader also ask emergency institutions, including hospitals, to provide all di necessary support to safeguard lives of di pipo dem don rescue.