Champlain Towers South: 99 pipo still dey miss for Miami building collapse
At least one pesin don die and 51 others dey miss afta one 12-storey residential building collapse overnight for north of Miami, Florida, according to officials.
Rescuers dey comb di rubble in search for survivors and dem bin pull one boy out alive.
E no dey clear how many pipo bin dey inside di building at di time.
Dem build di complex wey dey di town of Surfside for 1980. Out of 130 units, about half were affected by the collapse.



Wia dis foto come from, Google Street View

Rescuers use crane to reach residents for nearby apartments in order to help them comot.
One man wey bin comot wit im brothers dey walk dia dog describe how im hear di building collapse.
"Basically we hear one really big rumble and we bin think say na motorcycle, you know, and we turned around come see cloud of dust just dey come wia we dey," him tell CBS Miami.
"We dey like - 'wetin dey happun?' We rush toward am with our shirts ova our face and den di security guard come outside na so we begin ask, 'wetin happun?' and she say di building collapse."
End of Di one wey oda users dey read well well
One man wey witness di collapse afta e happun tell CNN, "E look like something from 9/11," e bin dey refer to di attacks wey bring down di Twin Towers for New York for 2001.
Santo Mejil, wey dey 50 years, bin wake up wen im wife call from one unit for di ninth floor of one of di three buildings wey make up Champlain Towers. She be overnight caretaker for one elderly disabled woman.
One man wey dey live for di neighbouring building describe wetin happun to CBS: "Di building shake and then I look out of di window and no see anything, E dey like storm or something wey dey come in.
More dey come.











