PDP National Convention 2021: Senator Iyorchia Ayuh na di PDP new national chairman

Wia dis foto come from, IYORCHIA AYU
Senator Iyorchia Ayu don become di new National Chairman of di Peoples Democratic Party (PDP) afta dia national convention wey happen for Abuja.
Even though nobody dey drag di position wit am e still get 3426 votes to become winner.
Di former senate president for di kontri third republic (1992-1993) be di consensus candidate for di position and go now dey dey in charge of di leadership of di main opposition party wit 19 oda officials wey dem elected for di PDP national working committee.
Dem elect di new set of leaders for di Eagle's Square, Abuja , di venue for dia national convention wey start on Saturday and kontinu di early mor-mor on Sunday.
Addressing di convention, Ayuh say even though di party don go see plenti rough road, im don come back to rescue di kontri from di mess wey e dey face.
E say mani pipo think say di party convention go lead to break up of di party but as e be, dia dream no come thru.
E say di party go move ahead to develop di Nigeria.
Dis na di names of di PDP New leaders:
End of Di one wey oda users dey read well well
- Iyorchia Ayuh - national chairman
- Umar Iliya Damagum - deputy national chairman (North)
- Taofeek Arapaja - deputy national chairman (South)
- Samuel Anyanwu - national secretary
- Ahmed Yayari Mohammed - national treasurer
- Umar Bature - national organizing secretary
- Daniel Woyegikuro - national financial secretary
- Stella Effah-Attoe - national woman leader
- Mohammed Kadade Suleiman - national youth leader
- Kamaldeen Adeyemi Ajibade - national legal adviser
- Debo Ologunagba - national publicity secretary
- Okechukwu Obiechina Daniel - national auditor
- Setonji Koshoede - deputy national secretary
- Ndubisi Eneh David - deputy national treasurer
- Ibrahim Abdullahi - deputy national publicity secretary
- Ighoyota Amori - deputy national organizing secretary
- Adamu Kamale - deputy national financial secretary
- Hajara Yakubu Wanka - deputy national woman leader
- Timothy Osadolor - deputy national youth leader
- Okechukwu Osuoha - deputy national legal adviser
How di national convention take happen
Delegates for Nigeria main opposition party, di Peoples Democratic Party (PDP) gada to elect new national leaders wey dem believe go lead di party for di next four years.
Ova 3,000 pipo gada for di Eagle's Square, for Abuja di konti capital for di national convention wit di hope say di leaders wey dem choose go give di party winning chance for di next major elections wey go dey for 2023.
Di convention suppose shele today and tomorrow and na very important part for di party preparation for di 2023 elections for di kontri.
Sometin wey di Chairman of di national convention committee, Ahmad Umaru Fintiri also believe as im say di new leaders go make di party dey kampe to win di 2023 election.
Govnors and ex-govnors, party officials and ogbonge pipo for di party don show as security tight for di venue of di convention.

BBC Pidgin tori pesin Dooshima Abu wey dey ground tok say di Eagle's Square just be like say dem do party as crowd full everywia.
Meet di new national chairman of di PDP
Ex-Senate president, Iyorchia Ayuh emerge as consensus candidate for di Peoples Democratic Party as dem dey find way to take ova power for Nigeria ahead of di 2023 general elections.

Wia dis foto come from, Facebook
Di endorsement follow afta di party national executive committee bin zone di national chairmanship position to di north.
Oda tins to sabi about Senator Ayuh
Na for Gboko, Benue state dem born Senator Ayu.
E bin dey lecture for di University of Jos before e enta politics.
At one time e comot from di Peoples Democratic Party go dia main opposition den join di Action Congress (AC).
For February 2007, Ayu dey arrested on top accuse terrorism but dem later release am on bail.
Im bin dey run tins as president of di senate for Nigeria Third Republic (1992-1993).
Later e hold different ministerial positions inisde di Cabinet of President Olusegun Obasanjo between 1999 and 2007.
All eyes son di PDP convention
Di 2021 convention dey happun in di middle of plenti political kasala wey don shake di party but di 29 October judgement by one Appeal court for Rivers state make party members mind coolele.
Di former chairman of di party, Uche Secondus, bin dey challenge im suspension and im bin try to block di party to hold di convention to hold.

Many party members bin claim say Oga Secondus no sabi run di party wella and dat unda im tenure planti members cross go di opposition parties - sometin wey dem bin no like at all.
Chairman of di national convention committee, Ahmad Fintiri bin tok say most of di positions for di party don get consensus candidate but three positions dey ground wey pipo dey contest.
Dem be:
- Deputy National Chairman (North);
- Deputy National Chairman (South); and
- National Secretary.
See more fotos from di convention.
















