PDP national chairman: Senator Iyocha Ayuh fit be PDP new national chairman

Wia dis foto come from, IYORCHIA AYU
Iyorchia Ayu, fit dey endorsed as di new national chairman of Peoples Democratic Party [PDP].
Dat na if no last minute change happun ahead of Nigeria main opposition party convention dis month.
PDP members for di three geo-political zones for northern Nigeria adopt Senator Iyorchia Ayu on Thursday as dia consensus candidate for di position.
Di party National Executive Committee bin zone di national chairmanship position to di north.
PDP National Convention go hold for October 30th 2021 to replace Uche Secondus wey comot as chairman of di party.
National Publicity Secretary of PDP Kola Ologbodiyan tell BBC Pidgin say na for di national convention, di party go take final decision on weda to ratify am.
Ologbodiyan say oda pipo fit still come out to collect form, im no know.
Di National Executive Committee of di party for inside statement advise those wey get interest to occupy any position to buy forms on or before Friday October 15 2021.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di National Convention na di highest decision meeting point of a political party.
And dis particular one dey come afta crisis rock Nigeria main opposition party.
Who be Iyorchia Ayu

Wia dis foto come from, IYORCHIA AYU
Iyorchia Ayu na former Nigerian Senator wey dey elected President of di Senate during di Nigerian Third Republic from 1992 to 1993.
E later serve for various Ministerial positions for di Cabinet of President Olusegun Obasanjo between 1999 and 2007. E serve as Minister of Industry, Internal Affairs and Environment.
During di military goment of General Sani Abacha, Ayu dey appointed as Minister of Education.
Na for Gboko, Benue state dem born Senator Ayu. E bin lecture for di University of Jos before e join politics.
E dey elected s Senator for di third republic under di Social Democratic Party and become Senate President.
For November, Senate impeach am.
According to reports, e say Ayu na di political god-father of George Akume, Benue govnor from 1999 to 2007.
Ayuh assist for di campaign to elect President Olusegun Obasanjo for 1999.
E later comot PDP, then join Action Congress. Ayuh lead di campaign to elect Vice President as President for 2007 election under di party.
For February 2007, Ayu dey arrested on top accuse terrorism.
E later dey released on bail.












