TRUTH Social Trump app: Donald Trump new social media platform explained

Wia dis foto come from, Getty Images
Former US President Donald Trump plans to launch new social media network TRUTH Social na big tori for town.
Oga Trump dey give dis announcement afta e bin chop ban from Twitter and suspension from Facebook.
Di social media platforms bin stop Trump afta di January 2021 US Capitol riots wey e supporters storm di US Capitol Hill.
TRUTH Social: Wetin di social media app dey all about
Donald Trump tok say di platform go "stand up to di tyranny of big tech".
Di 45th US Presido bin accuse big tech companies of silencing opposing voices for di US.
""I dey excited to soon begin sharing my thoughts on Truth Social and to fight back against big tech," Trump tok for one press release.

Wia dis foto come from, Truthsocial.com
E say di platform go dey open to "invited users" for beta launch in November.
E get plans to make am available to di entire public for di beginning of 2022.
End of Di one wey oda users dey read well well
Truth social go be product of one new venture wey dem call di Trump Media & Technology Group [TMTG].
Dem create di TMTG through merger with Digital World Acquisition Corp.
Di group tok say dem dey look forward to to become a publicly listed company.
Social media bin play very big role for oga Trump race for di White House and na im favourite means of communication as president.
Social media firms dey under pressure throughout oga Trump time as president to ban am, as some pipo dey criticise e posts as insulting, inflammatory or dey spread lie.
for 2020 Twitter and Facebook begin to delete some of Trump posts or label dem as misleading.
For example dem delete one wey e for tok say Covid no dey deadly than di flu.
Dem take dis decision to ban or suspend oga Trump afta di January riots.
Di riot follow one speech where Donald Trump make some kain claim of electoral fraud.
Responding to di riots, oga Trump call those wey dey Capitol "patriots" and show no sign of accepting di result of di election.
Dis come push Twitter and Facebook to rule say e dey too risky to allow am to continue to use dia sites.
Since then im and e advisers don give hint say dem dey plan to create rival social media site.
Di owners of Truth Social - TMTG intend to balance di playing field by providing pipo with open media platforms wia dem fit share and create content without fear of wetin dem call reputational ruin.












