Tiwa Savage video: Nigerian singer Tiwa reply blackmailer on alleged sex video

Wia dis foto come from, Tiwasavage/Instagram
Popular Nigerian singer Tiwa Savage wey don dey di news since last week don dey trend again sake of wetin she tell her allege blackmailers on top one sex video matter wey don dey cause katakata.
For inside post wey she put for social media, Tiwa savage bin tell di pipo wey dey behind di sex video say dem hate her sake of say she take di matter wey dem wan take destroy am joke for stage.
Last week, Tiwa Savage bin tok for one interview for The Angie Martinez show - for New York Power 105.1 fm. say e get some pipo wey dey try blackmail her over one allege sex tape and she don decide to call dia bluff as she no go pay dem shishi.
Tiwa savage say she don dey able to control di gbege since she don come out to tok about am.
But e be like say di allege blackmailer no too like di move as dem release one video on Monday evening as di so called sex video but e never dey clear whether na Tiwa Savage dey inside di video or not as BBC Pidgin never confam di originality.

Wia dis foto come from, TIWA SAVAGE INSTAGRAM
Tiwa bin write for di post say: "You hate how I dey able to control di narrative and get ahead of one story before e consume me and how i dey able to joke on stage about something you bin think say suppose destroy me and make me feel ashame."
"You must knock my head wen you see me otherwise…," she post.
Di Nigerian Afropop queen, bin also tok on stage during one show for Lagos say "nobody go ever see di sex tape".
End of Di one wey oda users dey read well well
Tok of di so called sex video don full for mouth of Nigerians as di matter trend number one for Nigerian Twitter on Tuesday.
Tiwa Savage - From Kele-Kele Love to Mavins Queen and now Universal Music sign on

Wia dis foto come from, Getty Images
Tiwa Savage burst for di Nigerian music scene for 2011 to catch dia attention with di gbedu wey dem call Kele Kele Love.
E feature love song wey Nigerians bin enjoy, she follow dat one wit plenti love gbedu wey include Love me, Love Me, Ife Wa Gbono.
And she also sing 'Don't Leave without my heart' wey she do with producer, Don Jazzy.
Then for 2013, she cari her tent pitch am for Mavins Records wia she drop two ogbonge albums Once Upon A Time for 2013 and R.E.D for 2016.
Na also for dia she get di name of Queen of Afrobeats.
Outside music, she bin feature for di Health TV Series wey dem bin call Sugar and also be activists against rape cases dem.
For May, 2020, Mama Jam-Jam (nickname of her pikin Jamil) port comot from Mavins to join Universal Music Group on an exclusive music deal wey go see her new music enta international market.
And true to di contract, wen for August she drop her fourth studio album, Celia. E see two songs for di album, Dangerous Love and Korobba peak for No 2 and No 9 for Billboards.
So far, Tiwa Savage don collabo with stars like Wizkid, Davido, Sam Smith, Beyonce, and Omarion.














