Tiwa Savage video: "I no go allow anybodi blackmail me for something wey dey natural”

Nigerian singer and songwriter Tiwa Savage

Wia dis foto come from, Tiwasavage/Instagram

Wetin we call dis foto, Nigerian singer and songwriter Tiwa Savage
Read am in 1 mins

Nigerian singer and songwriter Tiwa Savage don reveal say pesin dey try blackmail her wit her short sex clip.

She share dis totori for one radio show - The Angie Martinez show - for New York Power 105.1 fm.

"I no go call am sextape, but na video of me wit di pesin wey I dey see (date) right now".

For di interview, she tok say dem share video wit her wey show her wit di bobo wey she dey currently date.

She come tok say di pesin wey get di video come dey blackmail her and dey ask for money.

Wetin she tell her manager, afta she she share di video wit her be say: "No, if I pay now, two months later di pesin go come back, or two years…or even if I send di money, you (di pesin) still fit go release di video".

Angie Martinez come ask say no part of Tiwa, wan pay di money? And she tok say, no, say she no wan pay any money.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

She tok say wetin dey her mind na say na maybe if her mama see am or if her son see am.

"I go wan tok to am (my son) about am, so dat e go get mind to handle am".

Tiwa tok say she no wan make di video overshadow her hardwork and music.

Her message to her fans and pipo wey go wan support, she tok say: "just make e go".

She also tok say di mata make her cry.