Masten Wanjala: Kenya child 'serial killer' don die afta mob kill am

Masten Wanjala

Wia dis foto come from, Directorate of Criminal Investigations - Kenya

Wetin we call dis foto, Mr Wanjala confess say e drug and kill more dan 10 children
    • Author, Emmanuel Igunza
    • Role, BBC Africa, Nairobi

Police say one mob for Western Kenya don kill one man wey confess to serial killing wey escape from custody two days ago.

Villagers trace Masten Wanjala to one house for Bungoma town and beat am to death.

Authorities bin launch one ogbonge manhunt for di fugitive wey bin admit to killing more dan 10 young boys during a five-year period.

E bin also confessed to drugging dem and in some cases drinking dia blood.

Reports say e return to im parents home where neighbours wey find out say e dey dia strangle am, one eyewitness tell Kenya Standard newspaper.

E try to avoid suspicion from pipo by moving to a nearby house, Bungoma police commander tell di paper.

"We no dey sure how e manage to travel all di way from Nairobi to im rural home," Musyoki Mutungi tok. "Na di curious villagers wey first identify am go ahead to kill am even before di police hear about di mata."

Masten Wanjala suppose to appear in court on Wednesday over di murders of at least 14 boys for di capital, and areas of eastern and western Kenya.

Police say dem notice say e don disappear during di morning roll call.

Dem bin detain am during police investigations into di plenti tori child killings wey shock di nation.

Authorities don arrest three police officers wey dey on duty at di time of im escape from Jogoo Road police station, for di Eastlands area of Nairobi.

Dem arrest Mr Wanjala for July and im confess to drugging and killing di young boys, as well as drinking dia blood in some cases.