Dora Akunyili husband: Chike Akunyili die afta gunmen shot am

Dr. Chike Akunyili husband to late Prof. Dora Akunyili don die afta some unknown gunmen shot am.

For now, no official statement don come from di Police concerning wetin happun.

Videos of how Dr Chike Akunyili dey struggle for im life afta di gunmen attack dey circulate for some social media platforms.

Son of di late doctor, Ibumneme Akunyili tell BBC say Dr Akunyili bin dey return to Enugu from one meeting to honour e wife inside Onitsha wen di gunmen begin shoot im motor, kill am instantly with im driver and police orderly.

According to Obumneme, another of dia cousin wey survive di attack currently dey receive treatment for hospital.

Di incident happun for Umuoji inside Idemili North Local Goment Area of Anambra State on Tuesday evening, according to local media.

For some time now, south east Nigeria don dey hot sake of violent attacks.

Di tin don increase since separatist group Ipob declare 'sit at home' order every Monday since 9th august, 2021 in order to pressurize di Federal goment to release dia leader Nnamdi Kanu wey dem arrest on 29 June 2021.

Biography of Dr Chike Akunyili

Dr Chike Akunyili come from Agulu, inside Anambra State, South East Nigeria.

Before im death, Dr Chike dey run St Leo Hospital, wey be one of di biggest inside Enugu.

E graduate with first class and spend im professional career dey treat citizens across di kontri, including many on charitable grounds.

Dr Chike Akunyilli na husband to late Dora Akunyili wey be former Director General of National Agency for Food & Drug Administration (NAFDAC).

Di two of dem bin marry for 36years before she die of cancer for June 2014.

And dia marriage dey blessed with lovely children.