You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
UK temporary visa scheme for foreign lorry drivers and poultry workers - All you need know
Up to 10,500 lorry drivers and poultry workers fit get temporary UK visas.
Dis dey come as goment wan try limit disruption in di run-up to Christmas.
Goment confam say 5,000 fuel tanker and food lorry drivers go dey eligible to work for di UK for three months, until Christmas Eve.
Dem go also extend di scheme to accommodate 5,500 poultry workers.
Transport Secretary Grant Shapps say e go allow dem "ensure preparations remain on track" for di festive season.
But di British Chambers of Commerce say di measures be like to "throw a drop of water for big fire ".
Road Haulage Association say di announcement "barely scratch di surface... validity to Christmas Eve no dey long enough from wia we dey now".
But di freight industry group Logistics UK bin welcome di news and dem call di policy "a huge step forward to solving di disruption to supply chains".
End of Di one wey oda users dey read well well
Recruitment for additional short-term HGV drivers and poultry workers go begin in October, authority tok.
Di Road Haulage Association say: "Haulage companies go need full details on visas clearly presented on Monday so dem fit start recruitment processes.
Wetin make UK dey find lorry drivers?
Di shortage of drivers no dey make fuel deliveries go well, plus some petrol stations don close down, and queues dey form.
Di Road Haulage Association estimates say di UK dey short of about 100,000 HGV drivers - and di pandemic plus di Brexit move don make di shortage worse.
Di government and industry leaders don reassure the public - say fuel shortage no dey for refineries, and ask pipo make dem no dey do panic buying.
But di shortage of drivers don threaten more disruption to deliveries of petrol, food and oda goods.
Sainsbury say e dey experience "high demand" for fuel, wit a "tiny proportion of sites" wey dey temporarily closed.
BP say about 20 of im 1,200 petrol forecourts dey closed, as between 50 and 100 sites dey affected by di loss of at least one grade of fuel.
A "small number" of Tesco refilling stations don dey impacted, Esso wey be owner of ExxonMobil tok.
EG Group, wey get 341 petrol stations for di UK, dey introduce a limit of £30 per customer on all grades of fuel due to "unprecedented customer demand".
One petrol station for Stockport sell 5,280 gallons (24,000 litres) of fuel on Friday, compared to 1,760 gallons (8,000 litres) on di same day di previous week.
Di European Road Haulers Association say temporary visas go be "good idea" but na "only part of di solution".
Di association say e go dey easier to drive within di EU dan driving between di EU and di UK.
Dis one mean say to stay for di EU go dey more appealing for drivers.
Allan Davison, managing director of Hoyer Petrolog UK - BP's transport contractor - tell BBC say dem need di temporary visas.
"If dis na permanent request, I go understand di political and practical challenges wit dat, but no be so," he tok. "Na temporary request."
One Downing Street tok-tok pesin say: "We get ample fuel stocks for dis kontri and di public suppose dey reassured say shortages no dey."
Di tok-tok pesin say di goment dey look at temporary, time-limited measures to introduce.
"We dey move to a high wage, high skilled economy and businesses go need to adapt wit more investment in recruitment and training to provide long-term resilience," im add.