Monsurat Ojuade: Police officer wey allegedly shoot and kill 18 years old girl for Lagos go face murder charge

Police for Lagos state for southern Nigeria don dismiss one of dia officers wey allegedly shoot and kill one 18 years old secondary school leaver for Ijeshatedo area of di state.

Police tok-tok pesin for di state Adekunle Ajisebutu tok for statement say afta orderly room trial, dem dismiss Sgt Samuel Philips ontop di role im play for di killing of Miss Monsurat Ojuade on September 11 2021.

Police say dem dey carri di dismissed officer go court on Friday, September 24.

Tori be say di officer allegedly shoot Monsurat for her parents compound during one police raid for di area.

Police arrest di suspected officer and begin do in-house trial for im head. While dat one dey go on, dem also bin carri di body of di victim go do autopsy.

Till now dem never bury di victim. Di family bin allege say di officer dey shout say im go shoot wen im dey pursue di victim and her family members, say e keep to im word and shoot at close range.

Commissioner of police Lagos state Hakeem Odumosu and oda human rights groups don go pay condolence visit to di family.

For July ,police get anoda allegation say dia officer kill one sales girl Jumoke Oyeleke during one Yoruba nation rally for Lagos.

Police bIN deny say na dem kill di girl, say dem no shoot live bullet during di protest. Later autopsy report show say na sharp object kill di girl at close range. Till now dat case still dey court.

Cases of police brutality and unprofessionalism lead to di popular End Sars protest for Nigeria for 2020. Di kasala wey follow di protest lead to di killing of both civilian and non civilian citizens of Nigeria and destruction of properties worth millions of naira