David Paul Yonggi Cho death: Enoch Adeboye, Joshua Iginla mourn Pastor Yonggi Cho death, DCEM fix burial

Wia dis foto come from, Pastor E A Adeboye
Pastor Dr. David Paul Yonggi Cho, di owner of one of di world largest mega-church don die.
Di preacher na co-founder of di Yoido Full Gospel Church [Assemblies of God] for South Korea.
Yonggi Cho wey be age 85 die on Tuesday, im church confam for press release wey BBC Pidgin see.

Wia dis foto come from, Pastor David Yonggi Cho
At di time of im death, Dr Yonggi Cho bin dey receive medical treatment for brain hemorrhage wey e suffer from since 2020.
Cause of im death at 85 fit be dis sickness.
Nigeria popular preachers all respect dis South Korean Christian leader wella.
Pastor Enoch Adeboye of Redeemed Christian Church of God [RCCG] and Joshua Iginla dey mourn Yonggi Cho death.

Wia dis foto come from, Pastor David Yonggi Cho Ministry
David Yonggi Cho Biography
Dem born Cho for 1936 into a Buddhist family as dem live during di Korean War.
End of Di one wey oda users dey read well well
E convert to Christianity at age 17 - dis na afta doctors tell am sey e go die from a serious case of tuberculosis.
Cho pursue ministry full time and graduate from Full Gospel College for 1956.

Wia dis foto come from, Pastor David Yonggi Cho
For 1958 e open one small church for Seoul wey later become Yoido Full Gospel Church.
Afta many years di church grow into one of di most popular megachurches for di world.
Yoido Full Gospel Church get 500 church locations across South Korea.
Dem don also send thousands of missionaries to different kontris of I world.
Yoido get more dan 750,000 members.
Cho "don write several books and e found a Christian daily newspaper, and established a humanitarian organization, di church tok for press release.
Cho wife die for February dis year and dem get three sons together.

Wia dis foto come from, Screengrab/Facebook
Pastor David Yonggi Cho death: How Pastor E A Adeboye, Joshua Iginla mourn
Some Senior preachers don begin react to di death of Pastor David Yonggi Cho.
"Till we meet again on di resurrection morning, Rest in God's presence Pastor Dr. David Yonggi,"
Na so Pastor Enoch Adeboye of di Redeemed Christian Church of God tok.
Nigerian preacher, Prophet Joshua Iginla say Yonggi Cho na im "spiritual father".
Prophet Iginla for statement describe di international preacher as:
A "generational icon, trailblazer, pathfinder and a man wrapped in the immortality of God".
Yonggi Cho death: DCEM announce Pastor David Yonggi Cho funeral
Dem go bury am on September 18, 2021 for Cemetery of Osanri Choijashil Prayer Mountain.
Funeral service go hold by 8am for di main sanctuary of Yoido Full Gospel Church.
From Wednesday 15 to Friday 17 September dem schedule condolence for Yonggi Cho death.
Di condolence go take place from 7am to 10pm for Bethany Hall of Yoido Full Gospel Church.

Wia dis foto come from, DCEM












