Dudu Heritage Biography: Bimbo Oshin husband, Ola Ibironke don die

Dudu Heritage Biography: Bimbo Oshi husband, Ola Ibironke don die

Wia dis foto come from, Instagram/@princejidekosoko

Popular music promoter, Ola Ibironke, wey also dey known as Dudu Heritage don die.

Veteran actor, Prince Jide Kosoko confam di death for di instagram page and write; "Haaaaa.. Dudu, Dudu Heritage....dis dey shocking."

Dudu Heritage na prominent golfer for Ibadan, and husband to top actress, Bimbo Oshin.

Di wife, Bimbo Oshin neva put on any post on social media concerning di death of her husband.

Nigerian Publisher, Dele Momodu express im shock over di news of di death and say Dudu Heritage dey with dem on Friday Night before e die.

"Di gentleman on di right in white shirt bin dey with us on Friday evening... Last night, di news of im departure hit Nigeria like thunderbolt..."

"Bros, I see your IG post with my Golf Capo on Saturday. I receive call last night say e don die."

"Dudu Ibironke!!!!! What a life. May e gentle soul Rest In Peace..." May di soul of DUDU "HERITAGE" IBIRONKE Rest in Peace..." Dele Momodu tok.

Dudu Heritage Biography: Bimbo Oshin husband, Ola Ibironke don die

Wia dis foto come from, Instagram/Dele Momodu

No report don come out wey tok about di cause of di death of Dudu Heritage.

Biography of Ola Ibironke Aka Dudu Heritage

Dudu Heritage na music promoter wey bin live for United States some years ago before e relocate come Nigeria to run one private business.

During one old interview with local media, Ola Ibironke reveal di reason why e name e business outfit Dudu Heritage wey come later dey more popular than e name.

"I wanted to set up one African store for United States of America. So I come begin think of wetin I fit call am." Late Ola Ibironke bin tok for di interview.

"I chose Oracle, I chose Black Heritage, and about three oda names. But something now come to me, because of wetin di store go dey deal with, Africa items, music, and all di rest of it. And no be only Nigerians I wan serve.

"I want to give service to both black Americans and white Americans."

"My wife then suggested why we no put our native language in front of di heritage -dat na'Dudu Heritage'. "

Late Dudu Hertitage say entertainment to am dey like passion and na just fraction of wetin im dey do.

Dudu Hertitage na di Captain of di ogbonge Ibadan Golf Club (IGC) before e die.

Local media report say di Golf club tok for one statement say dem don close di course and suspend all club activities until further notice while dem raise di Flag at half-mast sake of di death of dia captain.

About Bimbo Oshin, wife of Dudu Heritage

Dudu Heritage Biography: Bimbo Oshin husband, Ola Ibironke don die

Wia dis foto come from, Instagram/Bimbo Oshin

Bimbo Oshin na talented actress wey come from Ondo town in Ondo State, Southwestern Nigeria.

According to her profile for Iroko TV, Bimbo Oshin come from family of eight and she be di second to di last child of di late Pa Olasanmi Theophilus Oshin.

She be graduate of di University of Lagos, Nigeria where she study Philosophy before she begin her acting profession.

Bimbo dey Married to Ola Ibironke of di Dudu Heritage, one of di top Yoruba Movie producers for di entertainment industry inside Nigeria.

She don act for several home videos wey include Eji Owuro, Owu Iya, Temi Yemi, Omo Elemosho and Akobi wey bring her to limelight.