You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Issac Owusu Bempah arrest: Ghana Court deny Owusu Bempah bail, detain am for one more week
Accra Circuit court detain controversial Ghanaian prophet, Isaac Owusu Bempah in police custody.
Despite pleading not guilty to charges including disturbing public peace, Her Honour Afia Owusuwaa Appiah deny am bail.
De Accra Regional Police Command arrest Isaac Owusu Bempah on Sunday.
E happun after heated confrontation with converted fetish priestess, Nana Agradaa over de weekend.
Ghana Police reveal how assistants who dey work plus Owusu Bempah assault some police officers during en arrest.
He go remain inside police custody den reappear on Monday, September 20.
Why police arrest Owusu Bempah
Prophet Isaac Owusu Bempah den three others dey arrested by Ghana Police Service for alleged assault of police officers while brandishing a weapon.
According to Police, dem arrest de Ghanaian preacher [Prophet Isaac Owusu Bempah] sake of one video in circulation.
End of Di one wey oda users dey read well well
He "create and circulate multiple videos which dey contain threats, brandishing of weapons den assault on police personnel."
Reports be say de Police arrest de pastor after he allegedly storm de premises of former fetish priestess, Nana Agradaa.
War of words between Prophet Owusu Bempah and converted fetish priestess Nana Agradaa
De tension between Rev Isaac Owusu Bempah den Nana Agradaa dey date back to earlier dis year.
Dat be when de fetish priestess accuse de prophet den others as fake.
Prophet Owusu Bempah react to de accusations by cursing Nana Agradaa.
De two since then dey inside war of words periodically until things escalate reach dis point.
In de latest episode, de viral video show one of de men who dey with de prophetdey brandish weapon while he dey threaten de woman.
De gun wielding man together with another man talk "see dis licensed gun I dey hold...Agradaa if you dey walk anywhere you for be careful."
"I swear Ghana no go fit contain us, 24 hours... If you say you get boys - walahi".
De men who dey refer to demselves as pastors under Prophet Owusu Bempah talk.
Reaction from Rev Isaac Owusu Bempah on im arrest
During de confrontation, Prophet Owusu Bempah approach de camera wey he make dis comment;
"She talk say she go teach me a lesson. So I come make she teach me lesson."
According to de prophet, "as we come here she carry gun, but my boys collect de gun. I talk am dem say make dem no shoot else she go die."
"I talk am say if she be woman make she come down. Her people " he add.
Nana Agradaa also during de confrontation talk say "Owusu Bempah come my house say he dey come kill me, Ghana Police!"
While she dey make dis comment other people dey shout from de Prophet camp, "make you come down here."
Nana Agradaa vs Issac Owusu Bempah arrest: Two suspects on de run plus court case
Police reveal for statement inside say two other suspects dey on de run.
Meanwhile, some men who dey with de prophet attach police personnel during de arrest.
De personnel officials at dey receive medical treatment, meanwhile dem cautioned general public against behavior which dey disturb public peace.