Montenegro Bishop inauguration fight: Wetin cause protest ahead of Orthodox Church leader inauguration

Demonstrators argue wit police during one protest against enthronement of Bishop Joanikije for Cetinje

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di protests for Cetinje reflect tensions for Montenegro, wey break away from Serbia for 2006

Thousands of demonstrators block roads for southern Montenegro for protest ontop di enthronement of one new Serbian Orthodox Church archbishop.

Angry crowds throw stones at police and pull down security fences around di monastery for di city of Cetinje wia di ceremony go take place on Sunday.

Demonstrators dey shout "Dis no be Serbia!" and "Long live Montenegro!"

Di protests reflect tensions for di kontri, wey end dia union wit Serbia for 2006.

Di Serbian Orthodox Church na Montenegro's largest religious institution, but e don dey in conflict with President Milo Djukanovic. Im claim say di Church dey try to undermine di kontri independence and bring Montenegro back under Serbia control.

Di president don beg protesters to disrupt di ceremony of di enthronement of Joanikije II to di top clerical position, wey dem sabi as Metropolitan of Montenegro and Archbishop of Cetinje.

"We dey on barricades today because we do tire for Belgrade to dey deny our nation, and tell us wetin be our religious rights," protestor Andjela Ivanovic tell tori pipo for Reuters news agency. "All religious objects [churches] wey dem build for Montenegro belong to pipo here and to di state of Montenegro."

Demonstrators shout at riot police during one protest against enthronement of Bishop Joanikije for Cetinje

Wia dis foto come from, Reuters

Demonstrators set up one barricade during one protest against di enthronement of Bishop Joanikije for Cetinje

Wia dis foto come from, Reuters

Demonstrators take part for one protest against enthronement of Bishop Joanikije for Cetinje

Wia dis foto come from, Reuters

Di president still dey para from di defeat im Democratic Party of Socialists (DPS) suffer for last year parliamentary election, wey come afta im push through legislation wey would don allow di state to claim Church property.

Di move backfire wen di Church campaign for di opposition, push di DPS comot from power for di first time in three decades.

Montenegrins wey identify as ethnic Serbs account for about one third of di kontri 630,000 population, according to di latest census data. Di majority of Montenegrins dey members of di Serbian Orthodox Church.