BBNaija evictions today: Maria, JMK, Sammie evicted from Shine Ya Eyes Big Brother Naija

Maria, JMK and Sammie chop eviction from Shine Ya Eyes Big Brother Naija House on Sunday.

Di housemates wey bin follow Maria, Jumoke [JMK] and Sammie collect eviction nomination include Pere, Cross and Queen .

Head of house Liquorose save Peace wey bin dey nominated come replace her wit Cross wey bin no dey nominated.

Jumoke Adedoyin [JMK] only join di TV reality show three weeks ago on 8 August, 2021.

Di 23-year-old law graduate JMK bin dey ready to spice things up in di House by being di life of di party.

She grow up for Ilorin Kwara State and bin hop say pipo go love her because she bring positive energy and mak pipo happy.

Maria Nkechinyere na 29-year-old from Imo State wey say she be lovely pesin and promise to entertain.

Maria serve as Head of House at some point for di house.

She be realtor wet dey sell houses for Dubai. After di show, she say she go try venture into business for Nigeria.

Maria dey single and hope to explore dating opportunities for di house.

26-year-old amateur filmmaker Sammie admit say im no dey above fighting for food inside Big Brother Naija House.

Sammie gree say yes na because im love food so much.