You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Alexx Ekubo and Fancy Acholonu breakup: Nigerian actor Alexx, fiancee Fancy wedding engagement break - See update
Alexx Ekubo wey be Nigerian actor and im fiancée Fancy Acholonu, wedding engagement breakup?
Dis na di kwesion wey dey di mind of many Nigerians afta reports begin dey fly upandan for social media.
On Wednesday 25 August, 2021 some news report say Alexx Ekubo and Acholonu don call off dia wedding engagement.
Fancy Acholonu confam to her fans and di public say her engagement and upcoming wedding with Alexx Ekubo don end.
"Hey guys, I dey write to info you all officially say I don end my relationship, engagement and I don call off di wedding with Alexx Ekubo."
"I know say dis fit shock many pipo. I make di best decision for myself, because e dey important say everyone find dia happiness and live in dia truth. "
"At dis time, my family and I ask you all to please respect our privacy . Thank you so much!" Fancy post for her Instagram handle.
Alexx Ekubo bin announce im engagement with e fiancé for e Instagram account on May 3, 2021.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di 35-year-old Nollywood actor then write wit excitement say;
"I ask di love of my life Fancy Acholonu to marry me…"
Fancy Acholonu come also post di same foto ontop her own personal account, where she reply:
"...& I tok YES to di love of my life."
Later on Monday 10th May Alexx announce di wedding date as November 20, 2021.
And both of dem create new instagram handle (@falexxforever) bearing di two names where fans go get informate, fotos and everything about di upcoming wedding.
Alexx Ekubo and Fancy Acholonu breakup: Wetin BBC Pidgin find out before Fancy confam news
We no fit find di new instagram handle wey Alexx and Fancy create for di wedding/marriage wen we search for am.
Also we no see di engagement photo wey Fancy Acholonu bin post May 3, 2021 for her instagram as at di time of dis report.
But Alex Ekubo still get photos and video of engagement plus oda photos and video of im and e fiance, Fancy.
Fancy Acholonu Instagram handle wey get 223k followers and dey follow 467 pipo no dey follow Alexx gain.
While Alexx wey dey verify with 4.2m followers and dey follow 754 pipo still dey follow im finance, Fancy.
BBC Pidgin also try reach both parties for response to wetin dey happen, but none don respond.
Alexx Ekubo Wedding announcement: Alex Ekubo and Fancy Acholonu marriage date
Di Nollywood actor announce on Monday May 10 say both di traditional and white wedding go hold for November of dis year.
Di wedding wey dem nickname, Falexx Forever, go hold for Imo state.
Alex Ekubo traditional marriage go hold on November 20, 2021.
And di Church wedding between di actor and im fiancee Fancy Acholonu go happun on November 27, 2021.
But fingers now dey crossed after di latest reports of wetin dey happun.