Musa Mustapha: Meet 11-year old world number one for tennis wey be Nigerian
Musa Mustapha of Nigeria don become di world under-11 table tennis numba one for di boys category.
Mustapha enter dis level wen di International table tennis federation, ITTF announce am for April dis 2021
ITTF talk say dem give am dis rank after dem calculate all di points wey Musa get for di different games and tournaments dem wey e don play, both for Nigeria and other countries.
Musa wey begin play since 2018 get total of 128 points to take be number one but still be number 17th for di under 13 boys category.
When BBC Pidgin follow am talk for Abuja, Musa talk say him happy for di level wen Im dey now but him bin no plan to win anytin, say him just day play di game dey go. E talk say him future plan na to become di world best table tennis player in no distant time.
Im papa, Mustapha Said, talk say him no too happy as di Nigerian government no get structure support to take dey encourage young talents like him son. Him wish say he dey hope say di system go fit try help am as na only him dey sponsor di boy for all di tournaments.
Musa Mustapha na di first ever Nigerian to become di world number one for any category on top table tennis.
He come from di family of table tennis players wia im papa, Mustapha Said, and all im siblings dey play, wey include him elder broda Mustapha Mustapha wey be di current world under 13 number 11.

