Anglican church for Ghana sack Priest wey kiss 3 female students

Wia dis foto come from, Other
De Anglican Communion Church for Ghana don sack de priest wey appear to kiss students for one viral video.
De church sack Reverend Father Balthazar Obeng Larbi on Tuesday afta dem hold one meeting to torchlight de matter.
Dem no blink eye to arrive at conclusion say make de priest commot from de St. Monica College of Education as priest plus say e no go serve as lawyer for de Ghana Education Service in de Ashanti region.
Dem sack am indefinitely as de church assure de public say dem dey give counselling to de three girls involved.
Rev. Father Balthazar Obeng Larbi "dey relieved of e duties as Chaplain of de College and all oda official duties pending investigations and recommendations from de committee", na so de church tok for one letter to de priest..
De church bin issue statement to confam de incident wey dem say dem make "saddened by de news wey dem institute thorough investigation into de mata immediately".
De statement further tok say dem dey do everything possible make dem provide de three female students with counselling to avoid trauma.
Videos wey dey circulate on-top social media show how one Anglican Rev father for St. Monica College of Education for Ghana dey give kiss three female students before cheering congregation as delta variant of Covid-19 dey surge for de kontri.
End of Di one wey oda users dey read well well
De video wey last for 25 seconds show how de father dey hold head of de girls dey give dem kiss one by one. De last student wey wear nose mask show some hesitation but de father signal say make she comot her nose mask for kiss wey she don gree do am.
Statement wey wee see dey suggest say some concerned students of de St. Monica College of Education for Kumasi dey justify de act of de Rev Father wey dem give en name as Father Larbi.
De statement tok say "on de morning of our Sunday service, (15th August, 2021), our school chaplain honour deserving students with certificates, sums of money wey en add kisses".
De statement continue tok say dem go fight for justice plus bloggers wey give wrong caption to de kissing tori.
Pipo for social media dey give different reactions but de church tok say dem go "deal with de action of de Priest in accordance wit norms and values off Anglican Communion."

Wia dis foto come from, Giftyandoappiah/Twitter











