Cryptocurrency heist hacker return $260m in funds of wetin e tiff from Poly Network

Wia dis foto come from, Getty Images
Di hacker behind one of di biggest cryptocurrency heist to date don return almost half of di $600m (£433m) of assets im tiff.
Na on Tuesday di company dem tiff from, Poly Network bin confam di heist as dem ask di hacker make dem meet to work out solution.
Di hacker den come post messages where e promise to return funds, as e claim say e no dey "very interested in money".
On Wednesday, Poly Network come confam say dem don receive $260m back.
Poly Network na blockchain platform wey dey allow users to exchange dia cyrpto for different type.
For Twitter, dem reveal say, di hacker return $3.3m Ethereum, $256m Binance Smart Chain (BSC) and $1m Polygon.

Wia dis foto come from, Getty Images
E still remain $269. for Ehtereum and $84m wey dey di hacker hand.
'Software weakness'
Di hacker publish three-page-long Q&A session on one of di blockchains wey dey in di form of a self-interview, according to Tom Robinson, co-founder of Elliptic, a London-based blockchain analytics and compliance firm.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di hacker claim say im plan na to always return di tokens and say dem carry out di heist to highlight weaknesses for Poly Network software.
"I know say e dey hurt wen pipo dey attacked, but dem no suppose learn something from those hacks?" di hacker write inside di notes wey dey embedded for di Ethereum blockchain.
Di technology behind crypto-currencies na blockchain - wey be distributed log of every single transaction made of a digital currency, wey dem dey send give all users on di network
Di hacker claim say e spend all night dey look for a weakness to take advantage of. Dem, say dem bin dey worried say Poly Network go fix di security palava quietly without telling anyone, so dem decide to take millions of dollars in cryptocurrency tokens to make a point.
But sabi pesin for crypto crimes Mr Robinson say di way blockchain be, e go hard for di hackers to profit from di digital currencies as every pesin for di network go see as di money dey move.
Di way blockchain dey work be say na ledger wey get all di transactions wey dey happun for di network but instead of to send am to one single ledger, di transaction dey shared with every pesin for di network.
BBC Cyber tori pesin, Joe Tidy say dis one just show how poqwerful hackers be for di unregulated world of crypto currency.













