Binance UK ban: Why FCA stop world biggest crypto-currency Exchange Company

Wia dis foto come from, Alamy
Di Financial Conduct Authority (FCA) rule say di company no fit do any "regulated activity" for di UK.
FCA also tear warning give pipo say make dem dey careful about Binance.com and dia adverts wey promise big money ontop cryptoasset investments.
Binance.com na online centralised exchange wey dey allow customers to trade different-different digital currencies, including Bitcoin.
Di website get digital wallets, savings accounts and dem even dey borrow pipo money.
Dis UK ban dey come as regulators from oda countries, including US, Japan and Canada, dey refuse to support and/or approve crypto-currency platforms.
Wetin FCA tok about Binance ban?

Wia dis foto come from, NURPHOTO
Di FCA say Binance Markets Limited (BML), wey dey owned by Binance Group, no currently get permission to do any legal business unless dem first collect "written consent" from dem.
BML, get until Wednesday to comply with di ruling, di regulator statement say.
Di UK regulator also warn say Binance Group no get any form of authorisation, registration or licence to do regulated business for di UK.
End of Di one wey oda users dey read well well
How di ban affect UK crypto traders

Wia dis foto come from, AFP
Di FCA no dey regulate crypto-currencies, but e dey regulate cryptoassets. Companies need to collect authorisation from di regulator in order to advertise or sell those kain products for UK.
Wetin e mean be say pipo for UK no dey allowed to use Binance to speculate or bet, on whether di price of crypto-currency like Bitcoin fit go up or down.
According to crypto expert, oga Colin Stone wey follow BBC World Service tok, pipo still dey allowed to use di website buy and sell crypto-currencies (as dis one no dey regulated).
Binance company reaction

Wia dis foto come from, Getty Images
Binance tell di BBC say di FCA announcement no get "direct impact" ontop services wey dem dey provide from dia website Binance.com.
"BML na separate legal business and e no dey offer any products or services via di Binance.com website," na so Binance tok tok pesin say.
"We dey work togeda wit regulators and we dey take our compliance obligations very seriously," im add.













