Rachel Oniga: Nollywood actress Rachael Oniga die at di age of 64

Wia dis foto come from, Other
Veteran Nollywood actress, Rachel Oniga don die at di age of 64.
Di family tok for statement say Rachel die for hospital on Friday night from heart-related issue and no be Covid-19 kill her like some pipo bin report.
Her family describe her death as "God design" and "function of a race of life well finished".
Dem say even though e dey "painful, dem accept in good faith and total submission to her maker"
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Rachel family call for privacy as dem mourn her death plus dem say dem go announce burial arrangement soon.
Dem born Oniga on 23 May, 1957 for Lagos State and she began her acting career for 1993.
Oniga wey come from Delta State don star for movies like Chief Daddy, Super Story and Onome.
Tori pf di veteran actress death dey come at a time wey Nigeria entertainment industry still dey mourn di passing of singer Sound Sultan.
End of Di one wey oda users dey read well well
Olanrewaju Ganiu Fasasi AKA Sound Sultan die on 11 July, 2021 from lung cancer.





!["Sound Sultan died": Olanrewaju Abdul-Ganiu Fasasi death, life and times 1976-2021 [Sound Sultan dead] died of 'Angioimmunoblastic T-cell lymphoma'](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/13A33/production/_119353408_soundsultandiedolanrewajuabdul-ganiufasasideathlifeandtimes1976-2021.png.webp)






