Sunday Igboho Cotonou court of appeal appearance for extradition toks - Wetin happun today

Wia dis foto come from, Sunday Igboho/BBC
Yoruba activist Sunday Adeyemo wey pipo sabi as Sunday Igboho show for court for Benin Republic on Thursday to take eye see how di toks and mata about weda dem go extradite am, wey mean say carry am go back to im kontri Nigeria go waka.
BBC Pidgin find out say, authorities carry Sunday Igboho and e wife go di court to witness wetin di Beninese prosecutors go decide ontop di mata of weda to extradite am back to Nigeria.
Moments afta dem arrive, di court enta private session wia security later ask journalists and oda supporters of di Yoruba activist wey bin dey ground to comot.
Lawyer to Igboho, Yomi Aliyu (SAN) tell tori pipo say dem just come register di case and no be today dem go get final words on wetin go happun to Igboho and e wife.
Na on Tuesday, 19, July, 2021 na im tori pipo start to dey report say authorities arrest di Yoruba activist for Cotonou, Benin Republic on Monday.
Tok bin dey ground say na wen Igboho and e wife bin wan travel comot from di kontri wit Benin Republic passport na im dem arrest am.
Dis details BBC no fit confam, as all efforts to get official confirmation of wetin happun for Cotonou no yield result as di authorities no release any official statement to confam or deny anything.
Igboho arrest come weeks afta Nigeria secret police, di Department of State Security Services, DSS bin declare Igboho wanted for allegedly stockpiling arms, allegation wey e don deny since.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wetin go happun next?
One judicial source for Benin don tell BBC say dem question Sunday Igboho for di criminal brigade.
Afta dem finish dat one, E go appear before di Cour d'Appel for Cotonou. Di court go examine di international arrest warrant.
If dem find am to be in order, di court fit extradite am. If dem no find am to be in order (maybe some legal or administrative issue with di warrant or oda concern), dem go refer am before di prosecutor.
As e no commit any of di alleged crimes for Benin, na di prosecutor go decide di next steps. Dat is if di Appeals Court find issue with di warrant.
So extradition dey on di table and dem fit even decide dat one on Friday.













