Sunday Igboho arrest news: Professor Banji Akintoye, Reno Omokri, kick against extradition and arrest of Yoruba activist Sunday Adeyemo from Cotonou Benin Republic

Sunday Igboho house attack in Ibadan: Police report on cancelled Lagos Yoruba nation rally

Local media for Nigeria dey report say authorities don gbab Yoruba activist Sunday Adeyemo, AKA Sunday Igboho for Cotonou, Benin Republic.

Dis one dey come weeks afta Nigeria secret police, di Department of State Security Services, DSS bin declare Igboho wanted for allegedly stockpiling arms, allegation wey e don deny since.

Wetin we know about tori of Sunday Igboho arrest

BBC Pidgin find out from pesin wey close to di case say dem arrest Sunday Igboho around 2:00am for Cotonou on Monday through joint operation.

As at di time of filing dis report, e still dey Cotonou for Benin Republic but dem go repatriate am to Nigeria and dem, go likely arraign am for court afta.

How pipo dey react

Leader of di umbrella body of Yoruba Self-Determination Groups, Professor Banji Akintoye say e don hear about di arrest of Yoruba activist Sunday Igboho for Benin Republic.

Professor Akinntoye, say e, alongside oda Yoruba Patriots wey dey immediately available dey currently work to provide assistance for Ighoho to prevent im extradition into Nigeria, say "Benin Republic na land wey respect di rules of law".

"I receive last night di troubling information say dem don arrest Chief Sunday Adeyemo wey dem dey call Igboho for Cotonou airport.

"I and oda Yoruba Patriots wey dey immediately available now dey work to provide di assistance wey dey necessary to ensure say nobody go dey able to do am anything unlawful or primitive and to prevent am from being extradited into Nigeria wey dey strongly possible.

Meanwhile, Ex-President Goodluck Jonathan former media aide, Reno Omokri don call on Yoruba socio-cultural organisation, Afenifere and Aare Ona Kakanfo, Gani Adams, to "openly start fundraiser for Sunday Igboho legal defence".

Reno, wey condemn di arrest, say e dey ready to donate for Igboho defence.

Wetin we call dis Video, Exclusive interview with Kaduna state Governor Nasir El-Rufai

DSS bin don tell Igboho to surrender afta dem raid im house weeks ago.

Afta di raid, Igboho tell BBC Pidgin say, two pipo die and several others bin dey miss afta unknown men wey wear military uniform enta im house for Soka area.

Afta series of rallies for different part of states for di south west, Igboho suppose lead rally for Lagos on Saturday, but e say dat don cancel now becos e no dey safe and im need to dey safe.

Di DSS bin explain say one joint operations for Sunday Igboho domot result in di death of two of im guards.

While odas escape with gunshot wounds and 13 suspects wey include 12 males plus one female dey DSS custody. E tok.

DSS bin parade items wey dem say dem recover from di Sunday Igboho house during di raid earlier today.

Afunanya say Ak-47, Pump Action, Pistols, 5000 rounds of ammunitions dey among items dem recover from Igboho house.

Wetin we call dis Video, Prof. Wole Soyinka react to Nnamdi Kanu arrest and Sunday Igboho house raid

Sunday Igboho begin make news afta e come forward since January 2021 wen e issue seven-day ultimatum to who e call killer herders for Ibarapa area of Oyo State.

Since den, e don lead im pipo and rally to demand for a Yoruba nation and to stop di farmers-herders clash for im region.

But authorities bin don cut several warnings give am about im ways and method.