Dunamis Pastor Dr Paul Enenche 'explain' wetin happun with di #BuhariMustGo activists wey storm im church

"Dr Paul Enenche" [Dunamis church]: 'Dunamis stop #BuhariMustGo activists for church'

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Worshippers for Dunamis International gospel centre in Abuja, Nigeria.

Dunamis International Gospel Centre for Abuja, Nigeria capital don release statement to explain wetin happun for dia church on Sunday, 4, July, 2021 and how dem arrest at least five #BuhariMustGo activists for di church premises.

According to reports, authorities som eactivists for Dr. Paul Enenche church on Sunday wit #BuhariMustGo T-shirts.

Omoyole Sowere, di convener of di group confam say dem arrest im comrades for di church.

"Dr Paul Enenche" [Dunamis church]: 'Dunamis stop #BuhariMustGo activists for church'

Wia dis foto come from, Dr Paul Enenche

Wetin we call dis foto, Dr Paul and Dr Mrs Becky Enenche na im be di lead pastors of Dunamis

Local media bin report say dem burst enta di church to protest against 'bad governance'.

Dem say drama start wen di church bin ask all first-timers to come out for prayers.

Na dia di activists file out with 'Buhari Must Go' T-shirts, begin chant wetin dem write ontop dia clothes.

According to di tori dem ignore di church administrators appeal to stop wetin dem dey do as dem instead march through to di altar.

Based on dis, na im, security operatives enta di mata to help pursue di demonstrators because di church service became rowdy.

"Dr Paul Enenche" [Dunamis church]: 'Dunamis stop #BuhariMustGo activists for church'

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Kasala burst wen 'Dr Paul Enenche Dunamis' International Gospel Centre church bin ask all first-timers to come out for prayers.

But Dunamis don release statement to wash hand comot di incident.

Di church distance demsef from di accusation of calling secret police (DSS) to arrest di activists.

Statement from Dunamis church

Wia dis foto come from, Dunamis

Di leader of di Take-It-Back movement, Omoyele Sowore bin criticise di church.

Sowore bin say e no happy say di church demand make im supporters delete di live-streamed videotapes from social media.

"Dr Paul Enenche security men for Dunamis International Gospel Centre don force di campaigners to delete di live-streamed videotapes...." E tok.

But e later do meeting with di pastor and tok say everything dey under control.

Dr Paul and Dr Mrs Becky Enenche na im be di lead pastors of Dunamis.

Both of dem be husband and wife from Benue State, central Nigeria.

We don update dis tori