Where was Nnamdi Kanu arrested?: Ipob leader arrest extradition location - Wetin we sabi
!["Nnamdi Kanu arrested today": [Ipob news] Where was Nnamdi Kanu arrested?: Ipob leader/Biafra separatist 'Nnamdi Kanu arrest' extradition tori](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/B92C/production/_119140474_nnamdikanuarrestinnigeriaipob'nnamdikanudeyarrested'hownigeriansreact.png.webp)
"Where was Nnamdi Kanu arrested?" We sabi say many wan know di ansa.
BBC Pidgin do some findings on di Ipob leader re-arrest/return to Nigeria, dis be wetin we find out.
British High Commission for Nigeria don reveal say dem no dey behind Nnamdi Kanu re-arrest and extradition.
One UK High Commission tok -tok pesin Dean Hurlock say dem dey aware of reports say di Nigerian goment don detain Kanu.
And dat dem no arrest am from UK for extradition purposes, Hurlock add.
Wetin UK wan do about Nnamdi Kanu extradition to Nigeria?
Di British High Commission for Abuja tell BBC Pidgin say dem dey in di process of seeking clarification from di Nigerian goment.
Dat na on top di circumstance wey lead to di arrest of Nnamdi Kanu, Dean Hurlock tok.
"Foreign, Commonwealth and Development Office stands ready to provide consular* assistance to Nnamdi Kanu as im dey face trial for Nigeria."
End of Di one wey oda users dey read well well
Hurlock add say d UK go expect say di trial or legal proceeding must follow due process.
Di UK dey refer to di Abuja High court trial wey go start on di 26th of July, 2021.
For 2017 wen Kanu jump bail for Nigeria, na UK wey e reappear.
Dis na because im be UK citizen and since then e don dey leave dia.
Na for UK e also launch Radio Biafra wey im dey use tok about im separatist struggle.
Nigeria goment believe say Kanu use im radio station to ginger civil uprising among pipo for southeast.
Even though e dey live for UK, e dey frequently travel to oda kontris like Israel, di United states and mainland Europe.

Wia dis foto come from, Other
So where exactly Nnamdi Kanu arrest happun?
Di Nigerian goment don refuse to reveal which kontri dem arrest Nnamadi Kanu from.
However, di speed wey di whole thin happun don shock evribodi including even im own supporters.
Attorney General of di Federation and Nigeria Minister of Justice, Abubakar Malami say:
Nigerian goment say na through plenti intelligence and cooperation wit Interpol and oda security for di kontri dem catch Mazi Nnamdi Kanu.
Malami say dem intercept and then return alias extradite Kanu come di kontri on Sunday.
But [Where was Nnamdi Kanu arrested?] - For dat direct kwesion, Malami no tok fim.
Meanwhile some security pipo tell BBC Pidgin say di goment no fit disclose where Kanu arrest and extradition happun.
Nigeria go expose di operational plan to di public, one expert tok.
Di banned Indigenous People of Biafra [IPOB] leader appear for court on Tuesday to face criminal charges.
Dat na two days after di day [Sunday 27 June, 2021] Nigerian goment say dem arrest Mazi Nnamdi Kanu.
!["Nnamdi Kanu arrested today": [Ipob news] Where was Nnamdi Kanu arrested?: Ipob leader/Biafra separatist 'Nnamdi Kanu arrest' extradition tori](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/14AF4/production/_119142748_nnamdikanuarrestedtoday-ipobnews'nnamdikanuextraditionarrest'innigeria'goappearfornigeriacourt-'abubakarmalami'.jpg.webp)
Wia dis foto come from, AFP
How Interpol dey cari arrest and extradite pipo on 'wanted list'?
Interpol dey operate for many kontri.
So if a kontri dey look for one criminal and dem discover say e dey a particular kontri, dem go write to di goment of di kontri wey di pesin dey hide.
If di goment decide to cooperate, e go ask di security of dat kontri to go catch di pesin.
Then hand am over to Interpol.
And dem go bring am to di home kontri wey e dey face charge.
Tori be say Nnamdi Kanu bin don move from UK and bin dey in transit through Europe.
Na during dis time wen im arrest happen, but where exactly? BBC Pidgin still dey dig.
!["Nnamdi Kanu arrested today": [Ipob news] Where was Nnamdi Kanu arrested?: Ipob leader/Biafra separatist 'Nnamdi Kanu arrest' extradition tori](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/1189B/production/_119153817_biafraseparatist'nnamdikanuarrest'extraditiontori.jpg.webp)
Wia dis foto come from, Other
[Where was Nnamdi Kanu arrested?] Kanu brother tok
Di pipo of South eastern Nigeria don move on since di arrest and detention of Nnamdi Kanu on Tuesday.
Observation for all di states for di region show sey pipo dey go about dia normal duty even though fear still dey as to wetin fit happen next.
"Dem subject Nnamdi Kanu to di most serious violations of international law.
"As im visit Kenya, dem detain Nnamdi Kanu and hand am over to di Nigerian authorities wey bring am back Nigeria," Kanu brother claim.
However Kenya High Commissioner to Nigeria tell BBC Pidgin say dem no get hand inside Kanu arrest and extradition.
Di High Commissioner Wilfred Machage say di claim dey wrong.
E challenge anyone wit evidence to bring am forward.
Also, di group wey Kanu dey lead wey goment don proscribe Ipob say di arrest of dia leader no go stop dia agitation for Biafran state.
But wen BBC Pidgin call di Interpol department for di police Headquarters Abuja, di oga kpata-kpata no respond to calls.




!["Nnamdi Kanu arrested today": [Ipob news] Ipob leader get "Umaru Dikko" treat?: What next for di 'Biafra separatist'](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/A8A7/production/_119157134_nnamdikanuarrestedtoday-ipobnewsipobleadergetumarudikkotreatwhatnextfordi'biafraseparatist'.jpg.webp)


!["Nnamdi Kanu arrested today": [Ipob news] 'Nnamdi Kanu extradition arrest' in Nigeria ', go appear for Nigeria court - 'Abubakar Malami'](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/E03C/production/_119140475_nnamdikanuarrestinnigeriaipob'nnamdikanudeyarrested'hownigeriansreact.png.webp)







