Bill Cosby charges dropped: "Bill Cosby sexual assault conviction" dey overturn by Court
!["Bill Cosby charges dropped": 'Court overturn Bill Cosby assault conviction', [vacated judgment order di American comedian release from prison]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/3223/production/_119153821_billcosbychargesdroppedvacatedjudgmentfor'billcosbysexualassaultcases'.jpg.webp)
Wia dis foto come from, Getty Images
Bill Cosby, di US comedian sexual assault conviction don dey overturned.
Pennsylvania Supreme Court ruling on Wednesday go pave way for im release.
Cosby, wey be 83 years old don serve more than two years of one three to 10-year sentence.
Na for April 2018 court for US say di comedian dey guilty of three counts of sexual assault.
!["Bill Cosby charges dropped": 'Court overturn Bill Cosby assault conviction', [vacated judgment order di American comedian release from prison]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/E12F/production/_103574675_tv049530263.jpg.webp)
Wia dis foto come from, Reuters
Bill Cosby currently dey serve im prison sentence for one state prison near Philadelphia.
Dem bin don find am guilty of drugging and molesting ex-basketball player Andrea Constand in 2004.
Cosby dey best known for starring in di 1980s TV series; "The Cosby Show".
"Cosby's convictions and judgment of sentence dey vacated.
End of Di one wey oda users dey read well well
"And im dey discharged," na wetin di court 79-page finding read on 30 June, 2021.
!["Bill Cosby charges dropped": 'Court overturn Bill Cosby assault conviction', [vacated judgment order di American comedian release from prison]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/96F7/production/_103574683_constandcosby.jpg.webp)
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin be di Bill Cosby charges court drop?
For retrial wey dey do for April, dem rule say Cosby dey guilty of three counts of sexual assault unto say im drug and molest Andrea Constand for 2004.
When Cosby ask for bail, dem deny am dat time.
"Mr Cosby you take her beautiful healthy young spirit and you crush am."
Judge Steven O'Neill tok for 2018 wen im give di sentence for di Montgomery County Courthouse for Norristown.
'Bill Cosby case' dat time involve Andrea Constand wey tok say di sexual assault no make her trust pipo again
"Dis na serious crime. Mr Cosby, tin don come back to you now. Di day don come, di time don come."
Pennsylvania Supreme Court on Wednesday vacate di 2018 judgement and order di release of Bill Cosby.













