Bill Cosby go enta prison for up to 10 years for sexual assault

Wia dis foto come from, Reuters
One judge for Pennsylvania don sentence comedian Bill Cosby to three to ten years for jail for sexual assault.
Cosby, 81, wey dem also categorise as 'sexually violent predator', wey mean say im must do counselling for di rest of im life and im name go dey onto sex offender registry.
Di actor no make statement wen dem give am chance to tok.
For retrial wey dey do for April, dem rule say Cosby dey guilty of three counts of sexual assault unto say im drug and molest Andrea Constand for 2004.
When Cosby ask for bail, dem deny am.
Wetin di judge tok?
"Mr Cosby you take her beautiful healthy young spirit and you crush am," Judge Steven O'Neill tok afta im give di sentence for di Montgomery County Courthouse for Norristown.
"Dis na serious crime. Mr Cosby, tin don come back to you now. Di day don come, di time don come."

Wia dis foto come from, Reuters
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

"Bill Cosby... steal my health and vitality; di way I dey free with pipo; and di trust wey I get in myself and odas."
End of Di one wey oda users dey read well well
Lili Bernard and former model Janice Dickinson - wey dem sef accuse Cosby of assault - tweet on Tuesday: "May justice be served! #MeToo".
Cosby wife, Camille, no dey for di court sentencing.

Wia dis foto come from, Getty Images












