Ecowas summit 2021: Ghana Accra agenda for 59th Ordinary Session of ECOWAS Heads of States

“Ecowas summit 2021”: [Ghana Accra agenda for 59th Ordinary Session of ECOWAS Authority of Heads of States and Governments]

Wia dis foto come from, Buhari Sallau

Read am in 4 mins

59th Ordinary Session of di ECOWAS Authority of Heads of State and Government hold on Saturday inside Accra, Ghana.

Dis meeting na follow up to di February 2021 extra ordinary summit of di Economic Community of West African States [Ecowas].

Na during dis meeting dem go adopt some of di reports wey dem don receieve since February as e concern dis operations.

Nigerian leaders, President Muhammadu Buhari and former president Goodluck Jonathan don land for Accra, for di ECOWAS meeting.

Dem join oda West Africa leaders wey dey attend di regional block summit wey President Nana Akufo-Addo of Ghana dey host.

Ecowas summit 2021: See di agenda for 59th Ordinary Session

"Ecowas summit 2021": [Ghana Accra agenda for 59th Ordinary Session of ECOWAS Authority of Heads of States and Governments]

Wia dis foto come from, Buhari Sallau

President Akufo-Addo tell oda west African leaders wey show face on Saturday say dem go enta closed door to discuss di following:

  • Covid Response
  • African Continental Free Trade Area (AfCFTA)
  • Eco - West African single Currency
  • Rotation of leadership inside di region and continent
  • Security challenges and terror attacks for West Africa
  • Sea Piracy - Operational maritime centers wey go battle dis concern
  • Mali Crisis mata
  • Strength of di regional block

Before dis 19 June Ecowas summit, di west African regional power house bin hold emergency meeting on Sunday May 30 2021.

Ecowas summit 2021: Ghana Accra agenda for 59th Ordinary Session of ECOWAS Heads of States

Wia dis foto come from, Ghana Presidency

Di one-day meeting for Accra bin discuss di situation for Mali wia di coup leader dia Col Assimi Goïta declare imself president on 24 May.

Ghana President wey also be di Chairman of ECOWAS, na im call for member head of states to come discuss Mali mata.

During dis 59th Ordinary Session of ECOWAS Authority of Heads of States and Governments former Nigerian president Goodluck Jonathan go present report.

Jonathan na im be di Ecowas special rep alias envoy ontop Mali go brief di west African leaders on di double coup inside Mali.

Nigeria bin don condemn di 24 May coup, plus how soldiers come later detain Mali president and prime minister.

"Ecowas summit 2021": [Ghana Accra agenda for 59th Ordinary Session of ECOWAS Authority of Heads of States and Governments]

Wia dis foto come from, Buhari Sallau

Host Ghana also dey expect say dem go use dis meeting address di need to review Africa position for di UN Security Council.

President Akufo-Addo wey yan dis one during di opening ceremony on Saturday also hail some west African kontris.

E commend dem for dia successful conduct of elections and change of political leadership recently inside dia nations.

Louise Mushikiwabo, di secretary general of La Francophonie also address di event as special guest wey di Ecowas chairman invite.

"Ecowas summit 2021": [Ghana Accra agenda for 59th Ordinary Session of ECOWAS Authority of Heads of States and Governments]

Wia dis foto come from, Buhari Sallau

Wetin we call dis foto, President Muhammadu Buhari and former president Goodluck Jonathan on Junee 19, 2021 for Accra. During dis 59th Ordinary Session of ECOWAS Authority of Heads of States and Governments former Nigerian president Goodluck Jonathan go present report.

President Muhammadu Buhari on Saturday call on West African leaders to mount pressure on Mali.

Buhari want Ecowas to make di military leadership in Mali ensure say transition process back to civilian rule no dey aborted.

Di Nigerian president position dey inside di statement im deliver give di 59th Ordinary session of di Authority of Heads of State and Government of ECOWAS in Accra, Ghana.

E speak on di situation in Mali, wey recently chop suspension from di regional bloc sake of military take over alias coup.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Resolutions from di 59th Ordinary Session of ECOWAS Heads of States

Jean-Claude Kassi Brou, president of di ECOWAS Commission, tell news conference after di summit say:

On di issue of Covid- 19 situation in member kontris, di summit say make member kontris continue to put in place all measures to contain di virus as vaccine supply still dey limited.

Issue of security - summit insist say make kontris implement di security regional plan wey ECOWAS approve for September 2019.

"Ecowas summit 2021": [Ghana Accra agenda for 59th Ordinary Session of ECOWAS Authority of Heads of States and Governments]

Wia dis foto come from, Ghana Presidency

Institutional reform of ECOWAS Institution: All 15 member kontris don agree to di reform of institutions afor di regional bloc. And dem also resolve to reduce di number of commissioners from 15 to 7 commissioners.

Single currency - Eco - New road map and new convention pact wey go cover 2022 - 2026 don dey ground. Sake of covid - 19, heads of states bin suspend di implementation of di convention pact for 2020/2021 but now dem don decide say make ministerial committee look am again. Dis new plan na to launch Eco single currency in 2027.

Two Francophone West African Neighbours, Senegal, and Guinea sign one deal to reopen dia borders to traffic afta many months of closure. Leaders of di two kontris reach di decision for di meeting of di ECOWAS authority of heads of states in Accra on Saturday.