Mali coup leader Assimi Goïta declare himself president - See di timeline of events so far

Assimi Goïta in September 2020

Wia dis foto come from, AFP

Mali former junta leader Col Assimi Goïta don declare himself di kontri transitional president.

E make di announcement afta im strip interim President Bah Ndaw and PM Moctar Ouane of dia powers.

Dem free di two ousted leaders from military detention, wia dem bin hold dem since Monday for wetin we fit see as Mali second coup in nine months.

Di seizure of power come afta one cabinet reshuffle wey Col Goïta complain say dem no consult am about.

Two army officers wey dey involved for di previous coup lose dia jobs for di reshuffle.

Col Goïta bin tok say President Bah Ndaw and PM Moctar Ouane fail in dia duties and dem bin dey try to sabotage di kontri transition.

Col Assimi Goïta (L), President Bah Ndaw (C) and Col Malick Diaw (R) - September 2020

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Col Goïta (L) bring President Ndaw (C) to power last year but remove am on Monday

Wetin happun to President Bah Ndaw and Prime Minister Moctar Ouane?

Mali interim President Bah Ndaw and Prime Minister Moctar Ouane resign afta di military detain dem for two days for di barracks of Kati near di capital, Bamako.

According to sources, di military force dem to resign as dem read and sign statements wey dem don write down hours before international communities' observers land di kontri.

During one high level meeting wit di troika delegation wey dey composed of Ecowas, AU and UN representatives, di two leaders announce their resignation.

Di West African mediators wey Nigeria former president Goodluck Jonathan dey part of, dey di kontri to arrange dia release from military detention.

Announcing dia release on Thursday, Col Goïta aide Baba Cissé tok say "we get nothing against dem".

He add say dem go keep dia whereabouts secret for dia own security.

Col Goïta say elections go still go ahead next year as planned.

Former Nigerian President Goodluck Jonathan (C) and other members of di Ecowas delegation speak to journalists afta dem meet wit Col Goïta

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Ecowas don dey insist on civilian rule

Timeline of Events

Soldiers for Mali detain di President Bah Ndaw and Prime Minister Moctar Ouane of di interim government on Monday.

According to di United Nations and di African Union, dis arrest go cause more political chaos for di sub-Saharan African kontri just nine months afta one military coup bin comot di former leader of di kontri.

Late on Monday, PM Ouane tell tori pipo for AFP for one phone call say, soldiers "bin come carry am". Di news agency say dj line later cut.

Di reported detention dey come just hours afta one government reshuffle, wey replace two senior army officers wey take part for last year coup.

Once again, Mali dey look unstable just nine months after di military coup wey comot President Ibrahim Boubakar Keïta from office.

Many Malians bin welcome oga Keita departure - but dem dey vex as military dominate di transitional goment and di slow pace of promised reforms for di kontri.

One previous coup wey happun for 2012 also lead to militant Islamists exploiting di instability to seize territory for northern Mali.

French troops bin help to regain territory, but attacks continue.