World Environmental Day theme 2021: Nigerians wey dey 'restore ecosystem, raise awareness'

World Environmental day

Wia dis foto come from, Getty Images

United Nation Secretary-General say humans dey damage di very ecosystem wey dey provide food for dem

Antonio Guterres tok dis one for im message to mark 2021 World Environment Day on Saturday.

Di UN chief add say di earth dey strong but e still need help from humans.

Experts on environment mata don call on Nigerians and goment to take environmental mata serious for pipo to get beta health.

David Faisal wey be environmental sabi pesin tok dis one as kontries dey mark di June 5, annual observance.

All ova di world, kontries dey celebrate World Environment Day June 5 every year to remind pipo about di importance of nature.

Di 'WED' observance na also reminder for dem not to take nature for granted.

Oga David Faisal say all di dirty wey Nigerians dem di pour anyhow dey block di water ways and e dey cause flood.

E say all Nigerians plus goment must take environmental mata serious and ensure say dem keep di environment safe.

"We dey scata di very ecosystems wey dey provide us with di food, water and resources we need to survive."

"Di Earth dey try to survive, but she need our help." United Nation Secretary-General Antonio Guterres tok for im message on World Environment Day

World Environmental day

Wia dis foto come from, Odas

Meet man wey say im mission na to rid Kano of plastic wastes

Hassan Rafin Kuka na young man wey dey stay Kano for northern Nigeria.

Im concern about im environment make am dey do daily waka to pick plastic wey pipo troway.

According to di 36 year old, five years ago some of im neighbours lose dia houses due to flooding wey e say na plastic wey block gutter cause.

Na dia Hassan make up im mind to helep comot plastic wastes.

World Environmental Day theme 2021:
Wetin we call dis foto, Hassan a times dey seek help from small children with sacks wey dey go round to also pick di plastic wastes from dia Rafin Kuka streets.

"I hate to dey see plastic waste, na why I make am a duty upon myself to dey go round pack dem inside bag then take recycle company."

"Plastic don do serious damage to my environment Kano state, e tok.

"Every rainy season dey get cases of flooding due plastics wey full drainages and no allow water pass.

"So na my mission to rid environment of plastics."

"Dis na something wey I go continue to do as far as I dey alive because i use my eyes see di danger wey plastic wastes dey cause." Im promise.

Di environment palava wey dey worry one creek wey flow inside major parts of Port Harcourt

Plastic bottles and oda wastes wey don dey block di Ntawogba creek wey pass through di City of Port Harcourt.

Dis yamya dem dey also stop oda nearby water bodies for Rivers State southern Nieria.

And na one big environmental challenge wey many pipo dey chook eye for as dem dey mark di 2021 World Environment Day.

Dis plastic pollution dey affect fishermen business for di state.

Fishermen dey complain say di pollution dey drive di fish comot from di water.

Sometimes sef, dem dey see di waterproof for di belle of some of di fish dem dey catch. According to wetin BBC Pidgin find out.

World Environmental Day theme 2021:

Even boat drivers sef don complain say time don reach for goment to take time clean di Rivers and waterways of plastic waste.

Dis na as e dey go hook for dia boat engines and if dem no take time, e fit cause accident and many times, e dey spoil dia engines.

Dis na im make some environment advocates dey try to go pack di plastic wastes and waterproof dem from some waterways and beaches around Port Harcourt.

And some sef dey try plant tree for mangroves to try restore di natural environment.

Di move na according to di theme for di 2021 World Environment Day wey dey encourage pipo to plant trees and do oda activities to restore dia environment.

How plastic waste and dirty dey affect Abuja

Nigerian Capital Abuja design na to show mega city wit beautiful landscape.

But in di pass years, as di population begin grow na so plastic waste dey litter every corner especially most of di council areas.

Most of di heap of dirty dey smell and make pipo wey di live for di area sick.

World Environmental day

Environmental concerns for southwest Nigeria.

Lagos state goment dey team up with some private organisations and NGOs to go clean up Sabo market to mark di World Environment Day inside Nigeria commercial Capital.

Commissioner for Environment Tunji Bello say one of di major environmental issues wey Lagos na plenti of waste evriwia.

Bello say dem don give out about 30,000 jobs to tackle dis matter and oda environment related matter.

E say dem don dey do waste recycling wey go help reduce di amount of wey di state dey generate.

Lagos State now get recycling bank for di ministry. Di commissioner add.

To reduce climate change, e say di state don create more parks and gardens.

And dem dey do landscaping and beautification of new sites. E tok.

World Environmental Day theme 2021: Updates across Nigeria of how pipo dey mark WED

For Ogun state, di goment rehabilitate di Arakanga dam.

Di move na go help treat and distribute potable water to di pipo wey don dey experience clean water wahala for some time now.

Di state don also sign memorandum of understanding with di Nigeria goment to rehabilitate di Ota water scheme.

All dis na to help end di water challenges wey di state don dey experience for sometime now.

Di major flood wey happun for some parts of Ogun state for November 2019 never repeat again as goment say dem dey put in more effort to end every environmental issue wey dey worri di state.

Di state dey construct major drainages for roads to control flooding in the state as flooding na one of di major environmental challenges for di state.

For Oyo state, govnor Makinde commission plenti new boreholes for di state to help di poor water conditions of di state. E say e go try to ensure pipo get access to clean water.

For 2018, dem declare state of emergency for di Nigeria water, sanitation and hygiene sector sake of say over 60 million Nigerians dey live without access to basic drinking water.

World Environmental day

History of World Environmental Day

World Environment Day na one of di biggest annual events wey United Nations (UN) dey organise to make pipo know about di important of nature and greenery.

United Nations Assembly establish World Environment Day for 1972, wey be di first day of di Stockholm Conference on di human environment.

For 1974, dem celebrate am with di theme 'Only One Earth'. Since then, different host kontries don dey celebrate am.

Di theme for dis year World Environment Day 2021 na 'Ecosystem Restoration' and Pakistan na im go be di global host for dis big day.