Twitter ban in Nigeria: Canada, US UK, odas react to suspension as Buhari government explain why dem ban di social media site

President Buhari

Wia dis foto come from, Drew Angerer

Wetin we call dis foto, Im speech, on Monday, na the shortest ever

Di diplomatic missions of Canada, the European Union (Delegation to Nigeria), the Republic of Ireland, the United Kingdom and the United States of America on Saturday express dia disappointment over Nigeria goment announcement say dem dey suspend Twitter and also propose registration requirements for oda social media.

Inside joint statement wey dem release, dem say dem strongly support di fundamental human right of free expression and access to information as pillar of democracy for Nigeria as around di world and these rights apply online as well as offline.

Dem add say di path to a more secure Nigeria dey with communication toward unity, peace and prosperity and dem ready to assist to achieve di goals.

Meanwhile, Nigeria presidency don explain in details di reason for di temporary suspension of Twitter for di kontri say social media platform dey cause problem of fake news and di company dey escape accountability.

According to statement wey Garba Shehu, Senior Special Assistant to di president sign, di suspension order dem sama Twitter on Friday no be just response to di removal of di president post.

"Plenty problems dey with di social media platform for Nigeria, wia misinformation and fake news wey dem spread through am don get real world violent consequences. All di while, di company don escape accountability.

"Nevertheless, di removal of President Buhari tweet dey disappointing. Di censoring seem to base on misunderstanding of di challenges wey Nigeria dey face today."

"Wen di president say they will be treated in a language they understand, e bin just dey tok say dia force go dey met with force. Na basic principle of security services response world over.

Dis no be promotion of hate, but a pledge to uphold citizens' right to freedom from harm. Goment cannot be expected to allow terrorists." Di statement add.

Nigerian Twitter ban and VPN: Twitter micro blogging site, local ISPs reply FG #TwitterBan

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Twitter Public Policy add say dem go work to restore access for all those in Nigeria wey dey rely on Twitter to communicate and connect with di world.

According to di presidency, Major tech companies must dey alive to dia responsibilities. Dem no fit dey allowed to continue to facilitate the spread of religious, racist, xenophobic and false messages wey dey capable of inciting whole communities against each oda, leading to loss of many lives. As dis fit tear kontries apart.

Dis statement dey also come as reactions from local and di international communities don condemn di ban.

Girl wey dey press phone inside bus

Wia dis foto come from, Getty Images

Violators go face prosecution

Di Attorney General of Nigeria, and Minister of Justice, Abubakar Malami, don call for di immediate prosecution of offenders of di Federal Government ban on Twitter operations in Nigeria.

Inside statement wey di special assistant on Media and Public Relations to di ministry, Umar Gwandu release on 5 June, Malami direct di Director of Public Prosecution of di Federation (DPPF) for di Office of di Attorney General of di Federation and Minister of Justice, to swing into action and start shaparly, di process of prosecution of violators of di Federal Government order on di De-activation of operations of Twitter for Nigeria.

According to Gwandu, any pesin wey violate goment order, weda na corporate, institution or individual from di point wey dem announce di suspension go face di law.

Nigerian Twitter ban and VPN: Twitter micro blogging site, local ISPs reply FG #TwitterBan

Wia dis foto come from, Jack Dorsey

Wetin we call dis foto, Twitter CEO Jack Dorsey wit staff of one tech company Andela for Lagos Nigeria wen e visit di west African nation in November 2019

Why Nigeria ban Twitter

Dis move by goment dey came just days afta Twitter remove one tweet by President Muhammadu Buhari wey dem say break dia site rules

Oga Mohammed bin criticise di US social media giant decision to take am down, e call di move "double standards".

Di tweet wey Presido Buhari send on 1 June bin dey refer to di 1967-70 Nigerian Civil War and di kain treatment "those wey dey misbehave today" wit "language wey dem go understand".

Tok-tok pesin for Twitter tok say dat post "break Twitter Rules".

Twitter na American microblogging and social networking service wia users post and interact wit messages wey dem dey call "tweets".

Nigerian Twitter ban and VPN: Twitter micro blogging site, local ISPs reply FG #TwitterBan

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Twitter na American microblogging and social networking service wia users post and interact wit messages wey dem dey call "tweets".

Wetin Twitter tok?

Di global policy team of di social networking site, Twitter Public Policy [@Policy] tweet ontop di mata say:

"We dey deeply concerned by di blocking of Twitter in Nigeria. Access to di free and #OpenInternet na one very important essential human right in modern society."

Twitter Public Policy add say dem go work to restore access for all those in Nigeria wey dey rely on Twitter to communicate and connect with di world.