Osun State Bank robbery update: Ikire, Apomu bank robbers kill pipo, attack police station

Police for Osun state say gunmen kill two if dia officers and two special constables during Wednesday Osun Bank robbery.
Di officers lost dia lives during di attack on two banks and police station on Wednesday.
Bullets also hit about three civilians during di attack wey start around 6:10pm in di evening, according to police.
Superintendent of Police Yemisi Opalola Olawoyin say di attackers dey about 35.
And dem carry about five vehicles attack di Ikire Divisional police headquarters and dia armoured tank wit plenti explosives.
She say di robbers wan subdue di police first before dem go attack di access bank and di first bank wey dey do area.
According to di PPRO, di robbers no succeed in robbing any of the banks sake of how dia officers attack with strong fire power.
She say plenti security formations follow attack di robbers including di Prompt Response Unit PRU, CP Surveillance Team, IRT operatives, STS, 39 PMF, JTF and local security outfits.
End of Di one wey oda users dey read well well
Panic as Osun bank robbery kill pipo, hit police station

Wia dis foto come from, Fisayo Soyombo
Robbers storm two towns inside Osun State wia dem hit two commercial banks.
Di robbers also attack a police station, inside di southwest state on Wednesday, 2 June, 2021.
Police don confirm di bank robbery dem and di attack on dia station by di robbers.
Tori be say di suspected robbers land a about 5.30- 6pm and begin shoot anyhow wey come cause great panic.
Di towns dem attack na Apomu, di headquarters of Isokan Local Goment Area and Ikire, headquarters of Irewole Local Goment Area. .
According to local report dem attack First Bank in Ikire and Access Bank inside Apomu.
Another report say di robbers first attack di Apomu bank before moving to Ikire, according to PM News wey quote wetin residents tok.
Di robbers enter Apomu and Ikire through Ikoyi town, and divide demselves into different groups before dem attack di police station.
And then hit di affected banks, one of which dey for Oke-Ola area.

Wia dis foto come from, File foto
Di second bank dey near Akire Palace while di affected police station na di Ayedaade Police Station.
Di armed robbers however japa through Orileowu road afta some local hunters and policemen confront dem.
Di amount of loot wey di robbers tiff carri go dey yet unknown but dem kill at least four pipo inside di two attacks.
Osun State Police Command tok tok pesin, SP Yemisi Opalola, confirm di robberies.
"Di robbers attack two banks and dem kill some pipo. Dem attack a police station during di operation", she tok.
Osun State don record similar bank robbery in di past wit dare-devil robbers.
Dis particular incident don add to di rising insecurity across Nigeria.





!["Ahmad Gulak Nigeria": Police report on [Gulak murder for Imo State]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/837F/production/_118736633_ahmadgulaknigeriapolicereporton-gulakmurderforimostate.jpg.webp)









