Ondo school bus attack: Gunmen hijack bus wit Chimola Schools pupils, staff near Akure

School staff wey bin follow di stolen bus

Some gunmen don tiff one school bus wit pupils and staff for Oba-Ile near Akure, Ondo State southwest Nigeria.

About eight gunmen bin ride Okada corner di motor as e bin dey go round to cari dia pupils go school on Thursday early mor-mor.

BBC confam say dem no kidnap any school pikin for di hijack but di gunmen bin drag di driver comot di motor.

Chimola Schools authority say dem cari di teacher wey bin join di bus enta forest before dem release am.

Ondo school bus attack: Gunmen hijack bus wit Chimola Schools pupils, staff for Akure

Di bus attendant tell BBC say dem bin cari am drop inside forest before di gunmen cari di motor waka.

Di principal of Chimola Schools for Akure, Bolatito Akindemowa na im confam di tori.

She say dem don get back di staff wey bin dey follow di teacher as well as di driver wey tok say di gunmen bin rob am.

Akindemowa also confam say none of di pikin wey bin dey di bus bin lost.