President Buhari say 'rude shock dey come for pipo wey wan destroy' Nigeria

Wia dis foto come from, Drew Angerer
President Muhammadu Buhari on Tuesday issue ogbonge warning to those wey wan destroy di kontri and burn down national asset say "rude shock dey wait dem, very soon."
Di President tok afta im receive briefing from chairman of di Independent National Electoral Commission (INEC), Prof Mahmood Yakubu, on series of attacks on facilities of di electoral body across di kontri.
"I receive daily security reports on di attacks, and e dey very clear say those behind dem wan dis administration to fail," President Buhari tok.
Insecurity for southeast and Northern Nigeria
Recently, attacks by gunmen don increase for south-eastern Nigeria and cases of banditry, kidnapping and terrorism for di North of di kontri never go away despite increase effort by di goment.
Attacks to both state and federal facilities by dis gunmen don become order of di day as Nigeria police don record many deaths of dia officers wey dey on duty.
Most schools both secondary and tertiary institution don become serious target for Nigeria.
And recently, attacks on both INEC and Police stations don too much.
Na sake of dis presido dey scream say di insecurity mata for Nigeria don become topic across di world.
End of Di one wey oda users dey read well well
See oda tins Buhari tok
"Insecurity for Nigeria dey now mentioned all over di world. All di pipo who wan power, whoever them be, you wonder wetin dem really want.
"Whoever want di destruction of di system go soon get di shock of dia lives. We don give dem enough time."
President Buhari recall say im bin visit all di 36 states of di kontri before di 2019 election, "and majority of di pipo believe me, and di election prove am." Im promise to continue leading di kontri in accordance wit Constitutional provisions.
Nigerian president say those wey dey misbehave for certain parts of di kontri dey obviously too young to know di travails and loss of lives wey happun during di Nigerian Civil War.
"Those of us wey dey field for 30 months, who go through di war, go treat them for di language dem understand.
"We go dey very hard sooner than later."
Di President say Service Chiefs and di Inspector General of Police don dey changed, "and we go demand security from dem."
On di dangers posed to future elections by di burning of INEC facilities, President Buhari say im go give di electoral commission everything e need to operate, "so dat no one go say we no wan go, or say we dey find third term. Excuse no go dey for failure. We go meet all INEC demands."
So far, e don get 42 cases of attacks on INEC offices nationwide, since di last General Election according to wetin INEC oga Yakubu tok as im brief di president.
Prof Yakubu say "Di 42 incidents so far happun for 14 states of di Federation for a variety of reasons"
Im say most of di attacks happun in di last seven months, and dem no dey related to protest against previous elections.




!["Ahmad Gulak Nigeria": Police report on [Gulak murder for Imo State]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/837F/production/_118736633_ahmadgulaknigeriapolicereporton-gulakmurderforimostate.jpg.webp)







