INEC Anambra, Enugu and Imo office attack - Commission declare 'national emergency'

INEC office catch fire
Read am in 3 mins

Nigeria Independent National Electoral Commission, INEC don declare di continued attacks on di joinbodi offices as national emergency afta anoda fresh attack on dia Anambra, Imo and Enugu state offices.

For inside statement wey di commission National Commissioner and Chairman, Information and Voter Education Committee Festus Okoye sign, release, INEC say three of dia offices come under attack at various times on Sunday night, 23rd of May, 2021.

According to di report, di attack on di Anambra state INEC office for Awka wey di unidentified pipo set on fire na im worse pass inside all di recent attacks on dia facilities as e be like say di attackers get wetin dem come to target.

Wetin dem say destroy for di Anambra office fire na Pavillion wey dey serve as Collation Centre during major elections, two stores wey dem put electoral materials and about 50% of non-sensitive materials dem need for di November 6, 2021 Governorship election wey dey come for di state also burn for di fire among oda tins.

INEC say dis one na major blow to preparations for di Governorship election wey dey come.

INEC office catch fire

For Imo state, INEC also report attack on dia office for Ahiazu Mbaise local government area around 6:45pm, but dat attack only succeed in damaging just a limited section of di building and no electoral materials or office equipment destroy.

Meanwhile di attackers also target INEC office for Igboeze South LGA around 1:00pm on di same Sunday.

Dem burn di store completely before di Neighbourhood Watch and Enugu State Fire Service bin respond to stop di spread of di fire.

Dis attack na di third attack on INEC office for di state in less dan two weeks afta dem attack dia office for Udenu LGA on 13th, May 2021 and di State Headquarters building for Enugu on di 16th of May, 2021.

Di commission add say although nobody die for di incidents, e dey obvious say na plan work to target INEC and prevent dem from conducting election mata, especially for Anambra.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

"Di attacks on di commission facilities now don become a national emergency. Accordingly, di commission go brief goment and stakeholders on dis incidenmts." Di statement tok.

Videos wey circulate for social media, capture how part of di INEC building bin dey on fire and rapid gunshots between pipo wey BBC Pidgin no fit independently confam.

Dis attack by unknown gunmen dey come only days afta jaguda pipo attack di outpost of di Nigerian Security and Civil Defence Corp (NSCDC), wia 2 officers die for Nneyi, Umueri, Anambra East LGA, Anambra State.

Police assure residents of safety

Police don assure Anambra residents of safety afta gunmen attack di INEC office for di state on Sunday.

For press conference, di state police tok tok pesin Ikenga Tochukwu say dem dey work wit di Military, and oda para military agencies and di DSS for one joint operation to keep di state safe.

Im debunk di tori wey dey go upandan for local news say 'Black Sunday in Awka', oga Tochukwu say no black Sunday for Awka, say nothing happun to all di police officers wey dey on patrol during di attack.

Im say dem no get any casualty for di attack wey happun on Sunday night.

"We record 95 percent success for dat attack, we just lost some parts of our buildings and di jaguda pipo burn four vehicles for INEC office."

INEC office catch fire

E ask pipo to go about dia normal duties as "God dey wit dem".

Im say dem dey work wit di Military, di Navy, Army, Civil Defence, Immigration and even di DSS for one joint operation to keep di city safe.

"Joint patrols don dey all ova our city, we are back on di streets to maintain law and order."

He also add say dem seize three vehicles and some guns from di jaguda pipo as investigation still dey go on to know di pipo wey dey behind di attack.