Ahmed Gulak: How Buhari, Atiku, odas react to di killing of former aide to Goodluck Jonathan

Wia dis foto come from, Gulak
Plenti pipo for Nigeria don dey react to di death of di former political adviser to former President Goodluck Jonathan , Ahmed Gulak wey some unknown gunmen kill for Owerri, Imo state capital on Sunday morning.
Di Imo State Police Command through dia toktok pesin Bala Elkana confirm Gulak death to BBC.
Oga Bala for statement say early on Sunday morning, "bandits block Ahmed Gulak around Umueze Obiangwu for Ngor-Okpala Local Government Area" come shoot am dead wen im dey on im way to Owerri airport to catch flight to Abuja.
Pipo wey kill Gulak go face justice- Buhari
Nigerian President Muhammadu Buhari don express outrage and disgust ova wetin e call "di murder of Adamawa politician Ahmed Gulak for Owerri, Imo State by yet to be identified gunmen."
For Statement wey im tok tok pesin Garba Shehu release, Oga Buhari tear warning give those wey carry out di killing say dem no go escape justice.
"We go deploy all resources wey dey our disposal to ensure dat we bring such callous and criminal elements to justice."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Di spate of killings across di kontri suppose worry evri Nigerian- Atiku Abubakar
For im own reaction, former Nigerian vice president, Atiku say ''evri Nigerian suppose dey concern wit di spate of killings across di kontri''
''Dis needless killings don enta pandemic levels. Di killings for Benue & shooting to death of former presidential adviser, Ahmed Gulak by yet-to-be-identified pesins dey condemned.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Screenshot
Assassination of Gulak na handiwork of ''skilled professionals''- FFK
Former Nigerian minister of Aviation Femi Fani-Kayode for one Twitter post say Gulak Killing na ''handiwork of skilled professionals''.
FFK condemn di killing of di deceased wey e say na im old friend pray dat God rest im soul.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Former Nigerian Senator, Shehu Sani write for Twitter ''Ahmed Gulak killed in Imo ....Road travels for some parts of di kontri don become a dangerous xpedition and a hellish experience.''
Before im death, Gulak bin be di Speaker of di Adamawa State House of Assembly. Im also be di chairman of di APC committee wey conduct di primaries for Imo governorship election.
Lately, di matter of insecurity for south-east don increase as jaguda pipo don destroy and burn state and federal properties for di region.
Di death of Gulak dey come on a day pipo for di south-east dey celebrate Biafra Day, wey be di day Lt Colonel, Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu announce di separation of Biafra from Nigeria for May 30, 1967.
Ahmed Gulak biography
Di late Ahmed Gulak na staunch politician from Adamawa state, North eastern Nigeria.
Gulak rise for politics start wen im become Speaker of di Adamawa state House of Assembly.
Im later become di Special adviser on Political matters to former President Goodluck Jonathan - di den president sack Gulak from office on April 29. Out of anger, Gulak resign im position as national coordinator of di Goodluck Support Group.
For January 2016 Ahmed Gulak pronounce himself di substantive chairman of di Peoples Democratic Party, PDP.
Before di 2019 general election, im join di All Progressives Congress (APC) from di People's Democratic Party (PDP) wia im bin serve as chairmo.
APC later select Ahmed Gulak as chairman of di APC govnorship primaries committee for Imo state.











