Kaduna strike: NLC Ayuba Wabba reply as Governor Nasir El-Rufai tweet say im dey wanted for economic sabotage sake of workers strike

Ayuba Wabba for Kaduna workers protest

Wia dis foto come from, NLC

Wetin we call dis foto, Ayuba Wabba for Kaduna workers protest on 17, May, 2021
Read am in 2 mins

Nigerian Labour Congress, NLC leader Ayuba Wabba don respond afta Kaduna state Governor Nasir El-Rufai declare say di national leader of di union dey wanted by authorities for economic sabotage.

Inside interview with BBC Pidgin, Wabba say El-Rufai yan na 'mere propaganda'.

Dis wan dey come afta Kaduna state governor say authorities don declare NLC oga Ayuba Wabba & others from di workers union wanted for economic sabotage and attacks on public infrastructure.

Di govnor tweet say anyone wey know wia e dey hide make e send message to di Ministry of Justice.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

But Wabba respond say NLC na respected organization and dem no go respond to wetin no make sense.

"Wetin una suppose dey ask am na say shey e sack 7000 workers,? E sack 7,000 workers and 11,000 dey on waiting list. Kaduna na di only state wey do dis kain tin, if e happun for any oda state we go go dia." Na so Wabba tok.

All dis one dey happun as di industrial action of workers for di state enta di second day.

Di workers dey protest di sack of thousands of workers for di state but di state goment insist say dem no do anything wrong.

Foto of kekes wey be major form of transport dey parked as no fuel for stations
Wetin we call dis foto, Many kekes wey be major form of transport dey parked as no fuel for stations

Airports, train stations, public schools and hospitals and others dey shut down as other commercial activities dey paralysed as di strike dey on.

Foto of Public school wey dey closed on day 2 of di strike
Wetin we call dis foto, Foto of Public school wey dey closed on day 2 of di strike

Nigeria Govnors Forum react

Inside statement wey di Nigeria Govnors Forum release, di govnors appeal to di NLC make dem calm down for dia case wit di Kaduna state goment.

Dem also remind di NLC say dia action fit dey backfire especially as 2020 really affect workers socially and economically.

Di forum encourage di union to get more open mind and understand why di Kaduna goment dey clean up di workforce.

"No see dis as witch hunt or attempt to unnecessarily downsize di civil service" as all states dey go through difficult times and each state dey try find how best to survive.