Lagos digital switch: Federal goment say Lagosians get six months to switchover

Lagos digital switch: Federal goment say Lagosians get six months to switchover

Wia dis foto come from, National Broadcasting Commission

Wetin we call dis foto, Free TV service wey di Nigerian goment launch go need decoder to work

Residents for Lagos State, Nigeria commercial capital go now get chance to watch television channels through digital broadcasting.

Nigeria Minister of Information and Culture Lai Mohammed, plus oda officials, formerly launch di Lagos switchover on Thursday.

Di digital switch na change over of television broadcasting from analogue to digital.

Na for Jos, Plateau State di federal goment bin first launch di new free-to-air service.

Dis na as di roll-out dey happen one phase after anoda.

Six months from 29 April, 2021, residents for di state alias Lagosians no go fit watch analogue television stations again.

Di federal goment regulatory joinbodi National Broadcasting Commission (NBC), announce am during di Lagos launch.

NBC say na because dem go switch off analogue television stations by den.

One afta anoda, di Nigeria goment officials wey talk say dis new digital television service go free Nigerians from di burden of big money wey commercial Pay TV companies dey collect.

Five key tins to know about Nigeria 'Free TV' digital service

  • First step na to get decoder or set-up box wey dem call ‘Free TV’ in order to watch di digital broadcast
  • Yearly fee of N1,500 ($4) go apply for every household to see di channels ontop ‘Free TV’ watch.
  • Dis annual money go be like BBC TV license for UK
  • Free TV decoder fit show up to 60 channels and dem dey available 24-hours a day
  • 70 percent of content go be local content wey go get TV shows, sitcoms, documentaries, music videos, drama series, talent and reality shows and sports.
  • Di Free TV decoders na Nigeria-made
  • Di Nigerian goment dey hope say di project go create 1 million jobs in di next three years

Nigeria begin dia switchover programme for 2016, ten years after Luxembourg, wey be di first kontri to fully switchover for 2006.

Plateau, Abuja, Kaduna, Kwara, Enugu and Osun states don already switch.

Kano, Rivers, Yobe, Gombe, Imo, Akwa Ibom, Oyo, Jigawa, Ebonyi, Katsina, Anambra and Delta, go follow.