Lai Mohammed response to Twitter choice of Ghana for dia Africa office

Wia dis foto come from, Getty Images
Honourable Minister of Information & Culture, Lai Mohammed don react to Twitter choice of Ghana over Nigeria for wia to put di company continental headquarters.
Twitter Oga Jack Dorsey announce on Monday say, di Tech giant don finally land for di continent, wit dia headquarter office situated in Ghana.
Reactions don follow why di Tech company chose Ghana over Nigeria considering di population size and other factors.
Oga Lai Mohammed tell tori pipo on Thursday say, di natural expectation na for Nigeria to be di Headquarters of Twitter office especially in dis part of Africa.
“Given di fact say we get about 25 million users in Nigeria against di 8 million wey dey for Ghana.
Clearly di decision no be commercial one."
He say Twitter get di exclusive right to choose wia dem wan put dia HQ.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di minister say "I hope say dis go serve as lesson to Nigerians.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis na wetin you get wen you demarket your own kontri.
We most times exaggerate di challenges di kontri dey face
At no time was dis better seen as during di End Sars protest wia Nigeria Journalist traditional and New media bin dey try to outgrow themselves in painting Nigeria as a hell wia nobody suppose go.
Dey all conspire to vilify not just di goment but di pipo.
I thank God di US vindicated di kontri say no single pesin was killed at di Lekki Toll gate protest. "
E advise Nigerians to dey patriotic say "Wen you destroy your own house, wia you go live?"












