Rochas Okorocha arrest: SA to di ex-govnor of Imo state say EFCC don release am

Senator Okorocha

Wia dis foto come from, Senator Rochas Okorocha

Former Imo state govnor wey di Economic and Financial Crimes Commission arrest don dey released.

Di Special Adviser on Media to di ex-govnor. Sam Onwuemeodo wey confam am inside statement say di commission release am on Thursday afternoon, nearly two days afta im arrest and e dey im house now.Di Nigeria corruption police operatives bin arrest di senator wey dey represent lmo West senatorial District on Tuesday, 13 April, 2021 for im Unity House office for Garki, Abuja.

Okorocha, wey be Imo state govnor between 2011 and 2019, dey accused of embezzlement and misappropriation of fraud, allegation wey e don deny.

Di Head of Media and Publicity for EFCC, Wilson Uwujaren, bin confam give BBC Pidgin say dem arrest Okorocha for Abuja.

Uwujaren, no gree tok on di reason why dem arrest di Senator wey dey represent Imo West Senatorial District and e no add any informate join.

Okorocha latest arrest dey come weeks after operatives of di Imo State Police Command arrest am for February on top accuse say e reopen one estate dem link to im wife.

Onwuemeodo for inside statement bin say nothing dey wrong if di Nigeria corruption police invite Okorocha as since e comot for office on May 28, di current administration don dey write different petitions against am.

E say, di EFCC don torchlight di petitions and di mata still dey different courts.

Oneuemeodo add join say dis no be di first time di commission go invite di former govnor and Okorocha go always cooperate wit di commission as di mata still dey courts.

We don update dis tori